Genesis 10
10:1 Na dis bi family wey Noah shidren: Shem, Ham and Jafet born, afta di flood happen.
10:2 Jafet shidren na Gomer, Magog, Madai, Javan, Tubal, Meshak and Tiras.
10:3 Gomer kon born Ashkenaz, Rifat and Togarmah.
10:4 Javan shidren na Elisha, Tarshish (wey bi Spain naw), Kittim pipol dem (wey bi Cyprus naw) and Dodanim pipol (wey bi Rhodes naw.)
10:5 Na dem bi di grand-grand papa to di pipol wey dey di land wey wota surround. Na dem bi Jaflet shidren-shidren.
10:6 Ham shidren na Kush, Mizraim, Put and Kanaan.
10:7 Kush shidren na Seba, Havilah, Sabtah, Rama and Sabteka. Rama shidren na Sheba and Dedan.
10:8 Kush na Nimrod papa, dis Nimrod kom bi warrior for di eart.
10:9 En na strong hunta for Oga God front. Dat na why dem dey sey, “Just like Nimrod wey bi strong hunta for God present.”
10:10 For di first time, en kingdom na Babel wey bi Babilon, Erek, Akkad and Kalneh wey dey Shinar land.
10:11 From dat land, e kon go Assyria where e for build Nineveh, Rehobot, Kalah
10:12 and Resen where dey di centre for Nineveh and di great town wey bi Kalah.
10:13 Mizraim (wey bi Egypt naw) shidren na Lud pipol (wey bi Lydia naw), Anam, Lehab, Naftuh,
10:14 Patrus, Kasluh (na from dem Filistia pipol from kom) and Kaftor pipol.
10:15 Kanaan shidren na Sidon wey bi en first pikin, Het,
10:16 Jebus, Amor, Girgash,
10:17 Hiv, Ark, Sin,
10:18 Arvad, Zemar and Hamat pipol. Leta, Kanaan family kon skata
10:19 and dia land kon wide from Sidon to Gerar go rish Gaza and from der to Sodom, Gomorrah, Admah and Zeboiim till e rish Lasha.
10:20 Dis na Ham shidren akordin to dia family, dia language, lands and kountries.
10:21 Dem still born some sons give Shem (wey bi Jafet senior broda) and na Shem bi papa to all Eber sons.
10:22 Shem shidren na Elam, Asshur, Arfaxad, Lud and Mash.
10:23 Aram shidren na Uz, Hul, Geta and Mash.
10:24 Arfaxad na Shelah papa and Shelah na Eber papa.
10:25 Eber get two sons: One name na Peleg, bikos na en time dem take divide di eart and en broda name na Joktan.
10:26 Joktan shidren na Almodad, Shelef, Hazar-Mavet, Jerah,
10:27 Hadoram, Uzal, Diklah,
10:28 Obal, Abimael, Sheba,
10:29 Ofir, Havilah and Jobab dem na Joktan sons.
10:30 Where dem dey stay na from Mesha go rish Sefar for di hill for east.
10:31 Dis na Shem sons akordin to dia family, language, lands and kountry.
10:32 Dis na Noah family akordin to dia generashon, kountry and dia pipol kon full di eart afta di rain don fall finish.