Genesis 2
2:1 God kon kreate evritin wey dey di heaven and di eart finish.
2:2 For di sevent day, God finish di work wey E dey do and E kon rest.
2:3 God bless di sevent day kon make am holy, bikos na dat day E stop all di work wey E dey do since.
2:4 Dis na di story about di heaven and eart wey God kreate.
2:5 For dis time, nor-tin don ever grow for di eart, bikos Oga God neva let rain fall and nobody dey wey go klear di groun or plant put.
2:6 But wota dey flow from di sea kon wet di groun.
2:7 So Oga God take some san-san for groun take mold man kon breath life enter en nose, den di man kon dey breath.
2:8 God make Eden Gardin for di east kon put di man wey E kreate for der.
2:9 God kon make difren trees make dem grow for di soil and dem dey good for food. (Naw, di tree wey get life, wey dey make pesin know tins well-well; wey dey good and bad, dey for di gardin centre.)
2:10 So as wota dey flow from Eden go wota di gardin, e dey from der, divide into four river.
2:11 Di first river name na Pishon; e dey flow for Havilah land, di place where gold dey.
2:12 (Di gold wey dey di land, dey pure and difren-difren good iron still dey der too.)
2:13 Di sekond river name na Gihon; e dey flow pass Kush land.
2:14 Di third river name na Tigris; e dey flow pass di east for Assyria. And di fourt one name, na Eufrates.
2:15 God take man kon put am for Eden Gardin, so dat e go kare for evritin.
2:16 Den Oga God kommand di man sey, “Yu fit chop from evry tree wey dey di gardin,
2:17 but make yu nor chop from di tree wey get life; wey dey make pesin know tins; di tree wey dey good and bad, bikos wen ever yu chop from am, na dat day, yu go die.”
2:18 Den God kon sey, “E nor good make only man dey. I go gi-am somebody wey go make belle sweet am.”
2:19 God make evritin wey get life from di groun. E bring dem kom meet di man make e give dem name and any name wey di man koll any animal, na dat name go follow am.
2:20 So man name all di animals, birds for di sky and evritin wey get life for di eart, but Adam nor si anytin wey bi like am.
2:21 So Oga God kon make man sleep deep sleep and as e dey sleep, God take one from di man rib kon use flesh kover di place.
2:22 Den Oga God make anoda pesin from di rib wey E take from di man, den E bring am kom meet di man.
2:23 Den di man sey, “At last, dis one bone kom from my bone and en flesh kom from my flesh; I go koll am, ‘Woman,’ bikos God make am from man.”
2:24 Dat na di rizin why man must live en papa and mama kon go stay with en wife and dem two go bikom one.
2:25 Di man and en wife nor wear anytin for body, but shame nor katch dem at-all.