Genesis 28
28:1 So Isaak koll Jakob kon bless am. Den e kommand am sey, “Make yu nor marry any Kanaan woman!
28:2 Make yu dey go Paddan Aram naw-naw! Make yu go Betuel house wey bi yor mama papa kon find wife for der among yor mama broda Laban dotas.
28:3 God wey get pawa well-well go always bless yu! E go make yu dey fruitful kon give yu plenty shidren! Den yu go bi very big nashon.
28:4 E go give yu and yor shidren-shidren di blessing wey E give Abraham, so dat una go take di land wey God give Abraham; di land wey yu just dey stay as strenjas.”
28:5 So Isaak send Jakob go and e go Paddan Aram go meet Betuel pikin Laban, di Aramean wey bi en mama Rebekah, broda.
28:6 Esau si sey Isaak don bless Jakob kon send am go Paddan Aram, so dat e go get wife for der. As Isaak dey bless am, e kommand am, “Make yu nor marry Kanaan woman.”
28:7 Jakob obey en papa and mama kon go Paddan Aram.
28:8 Na den Esau kon know sey en papa nor like di wimen from Kanaan.
28:9 So Esau go Ishmael kon marry Mahalat wey bi Nebaiot sista and na Ishmael, Abraham pikin born am. E marry dis one join di wifes wey e get before.
28:10 But Jakob komot Beersheba kon go Haran.
28:11 E rish one place where e stay small, bikos evening don dey rish. E take one among di stones kon put am near en head. Den sleep kon katch am for dat place
28:12 and e kon dream. E si one strait road wey from eart go rish heaven and God angels dey waka up-and-down for di road,
28:13 den Oga God stand for di top. God kon sey, “Na mi bi di Oga God, yor grand-papa Abraham and yor papa Isaak God. Dis groun wey yu sleep put so, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren.
28:14 Yor shidren-shidren go plenty like san-san for groun and dem go skata go west, east, nort and sout. I go bless all di family for di world with yu and shidren-shidren name.
28:15 I go dey with yu! I go guide yu for anywhere wey yu dey go kon bring yu kom back to dis land. I nor go leave yu until I don do wetin I promise yu!”
28:16 Den Jakob wake-up kon sey, “True-true, God dey dis place and I nor know!”
28:17 Bikos e dey fear, e kon sey, “Wish kind wonderful place bi dis! Dis nor bi any oda place, but na God house! Dis na heaven gate!”
28:18 Very early for di next morning, Jakob take di stone wey e put near en head kon keep am as holy stone. Den e pour oil on-top am.
28:19 E koll di place Bethel, even doh di name before na Luz.
28:20 Den Jakob promise sey, “If God dey with mi kon guide mi thru dis journey wey I dey do so and E give mi food make I chop with klot to wear
28:21 and I go back to my papa house sey nor-tin do mi, den di Oga God go bi my God.
28:22 Den dis stone wey I dey keep der as holy stone, go bi God house and I go make sure sey I give Yu back one out of evry ten tin wey Yu give mi.”