Genesis 30
30:1 Wen Rashel si sey e nor fit born shidren for en husband, e kon dey jealous Leah, en sista. Den e tell Jakob, “Make yu give mi shidren or I go die!”
30:2 Jakob kon dey vex with Rashel so e sey, “Na mi bi God wey neva give yu pikin?”
30:3 Rashel ansa, “I wont make yu sleep with my savant Bilhah, so dat e go born shidren for mi and I go kon get my own family thru am.”
30:4 So Rashel give en savant Bilhah to Jakob and Jakob kon sleep with am.
30:5 Bilhah get belle kon born boy pikin for Jakob.
30:6 Den Rashel sey, “God don save mi. E don ansa my prayers kon give mi boy pikin.” Dat na why Rashel koll di pikin Dan.
30:7 Rashel savant Bilhah kon get belle again for Jakob and e still born boy.
30:8 Den Rashel sey, “I don really fight betta fight with Leah, my sista and I don win.” So e koll di pikin Naftali.
30:9 Wen Leah si sey e nor fit born again, e kon give en savant Zilpah to Jakob.
30:10 E nor too tey before Leah savant Zilpah born boy for Jakob.
30:11 Leah kon sey, “E good well-well!” So e koll di pikin Gad.
30:12 Den Leah savant Zilpah born anoda pikin for Jakob.
30:13 Leah kon sey, “My belle dey sweet mi, bikos wimen go dey happy well-well, bikos of mi!” So e koll di pikin Asher.
30:14 So wen dem dey do di wheat feast, Reuben komot kon si some mandrake plants for di field, den e bring dem kon give en mama Leah. Rashel kon tell en sista Leah, “Make yu give mi some for di plant wey yor pikin bring.”
30:15 But Leah ansa, “So my husband wey yu take neva do yu? Yu won still take my pikin mandrake too?” Rashel ansa, “Okay, make yu give mi some mandrake and e go sleep with yu dis nite.”
30:16 Wen Jakob kom back from di field dat evening, Leah go meet am kon sey, “Yu must sleep with mi today o-o, bikos I don pay to get yu with my pikin mandrake.” So Jakob sleep with am dat nite.
30:17 God hear Leah prayer; so e kon get belle and e born anoda boy for Jakob for di fift time.
30:18 Den Leah sey, “God don give mi my reward, bikos I give my savant to my husband make e sleep with am.” So e koll am Issakar.
30:19 Leah get belle again and e born di nomba six boy.
30:20 Den Leah sey, “God don give mi betta gift. Naw, my husband go honor mi, bikos I don born six boys for am.” So e kon am Zebulun.
30:21 Afta, Leah born one girl kon koll am Dinah.
30:22 Den God sorry for Rashel. E hear en prayer kon make am get belle.
30:23 Rashel get belle kon born boy. Den Rashel sey, “God don take my shame komot.”
30:24 E kon koll am Josef wey mean, “Make God give mi anoda boy pikin.”
30:25 Afta Rashel don born Josef, Jakob kon tell Laban, “Make yu let mi go house go meet my own pipol for my own kountry.
30:26 Make I take my wifes and my shidren follow body, bikos I don work for yu.”
30:27 But Laban sey, “If really sey I dey good to yu, den yu go stay with mi, bikos my spirit tell mi sey, God bless mi, bikos of yu.”
30:28 Laban still tell Jakob, “Make yu just tell mi wetin I go pay and I go pay yu.”
30:29 Jakob ansa, “Yu know as I don work for yu and how I don kare for yor animals.
30:30 True-true, dem nor many wen I kom, but naw, wetin yu get don plenty well-well. God don bless yu for evriwhere wey I for work for yu. But naw, how long e go take before I go do sometin for my own family?”
30:31 So Laban ask, “Wetin yu wont make I give yu?” Jakob ansa, “Yu nor nid to give mi anytin, but if yu gri with dis one tin, I go kontinue to kare and guide yor animals:
30:32 Make yu let mi waka round all yor animal kon komot di ones wey get spot or mark or wey black. Dis animals go bi my pay.
30:33 Den my good go tok for mi leta, wen yu go si sey na only di ones wey yu give mi I take. If yu si any animal wey nor get mark, or spot or black, den make yu koll mi tif.”
30:34 Laban kon sey, “I gri! Make e bi as yu tok.”
30:35 So dat day, Laban komot all di animals wey get white spot, mark or wey black kon sey make en pikin kare for dem.
30:36 Den e separate dem from Jakob own with three days journey and Jakob kon dey kare for di oda animals.
30:37 But Jakob take fresh branches wey dem just kut from poplar, almond and plane tree kon peel dem until e si di white wood for inside.
30:38 Den e put di tree wood for di wota where di animals for dey drink. E put dem for di animals front wen dem dey chop and dem kon drink di wota.
30:39 Den wen di sheep dem sleep togeda for di branches front, dem kon dey born pikin wey get mark, spot and black.
30:40 Jakob kon separate doz animal from Laban own. Den wen di animals won sleep with each oda again, e kon turn dem face Laban own wey nor get spot and black. So e kon get animal for ensef and e nor mix dem with Laban own.
30:41 Wen di strong animals wey bi woman won sleep with man animal, Jakob go put di branches for wota, so dat dem go sleep togeda near di branches.
30:42 But if di animals dey weak, e nor go put di branches for dia front. Like dis, na Laban kon get all di weak animals and Jakob kon get di ones wey dey strong.
30:43 Like dis, Jakob kon get money, animals, both man and woman savant, kamel, donkey and plenty propaty.