Library · pcm

Genesis 33

33:1 Jakob look up kon si Esau dey kom with 400 men. So e kon divide di shidren among Leah, Rashel and en two savant. 33:2 E put di savant and dia shidren for front, den Leah and en shidren, den Rashel and en pikin kon follow for back. 33:3 But Jakob by ensef kon waka go dia front and e bow face groun seven times as e dey waka near en broda. 33:4 But Esau run go meet am kon hug and kiss am. Den di two of dem kon dey kry. 33:5 Wen Esau si di wimen and dia shidren, e kon ask, “Na who bi dis pipol wey dey with yu?” Jakob ansa, “Na di shidren wey God don give mi, yor savant.” 33:6 Di savants first kom bow with dia shidren for Esau. 33:7 Den Leah kom with en shidren kon bow, before Rashel and en pikin Josef kon bow for am. 33:8 Esau kon ask, “Wetin dey yor mind wey make yu send all dis tins kon give mi?” Jakob ansa, “My oga, na make yu for forgive mi.” 33:9 But Esau sey, “My broda, make yu keep wetin yu get, bikos di ones wey I get plenty rish for mi.” 33:10 But Jakob sey, “If yu know sey yu don forgive mi, den make yu take all dis gift wey I bring kom give yu. Bikos as I don si yor face and yu don forgive mi, e just bi like sey na God face I dey si. 33:11 So, abeg, make yu take all dis present wey I bring kon give yu, bikos God dey good to mi and I get evritin wey I wont.” Wen Jakob beg am well-well, e kon take dem. 33:12 Den Esau kon sey, “Make I dey go! I go dey go for yor front.” 33:13 Jakob kon tell Esau, “My oga, yu know sey di shidren still small and I dey kare for di animals wey just born, if wi sey make wi travel with dem for just one day, all di animals fit die. 33:14 So make my oga dey go for en savant front. I go dey kom small-small bikos of di shidren and di animals and I go meet yu for Seir.” 33:15 So Esau sey, “Make I leave some among my men with yu.” Jakob ansa, “Why yu still won do like dat? My oga, yu don try well-well.” 33:16 So, dat day, Esau kon go back to Seir. 33:17 But Jakob travel go Sukkot where e for build house for ensef and en animals. Dat na why dem dey koll dat place Sukkot. 33:18 Afta e don komot from Paddan Aram, Jakob kon rish Shekem town wey dey for Kanaan and e stay near di town. 33:19 Den e buy di field where e bin build en tent put; E buy am from Hamor pikin wey bi Shekem papa for one hundred silva. 33:20 For der, e build one altar kon name am, “Na Israel God bi God.”