Library · pcm

2 Samuel 22

22:1 David sing dis song afta God save am from Saul and en enemies: 22:2 “Na di Oga awa God dey protet mi; Na-im dey diliver mi. 22:3 Na God dey protet and save mi. Na-im bi my shield and E dey defend mi. E dey protet and save mi from danger. 22:4 I go praiz God, bikos wen ever I koll am, E dey save mi from my enemies! 22:5 Deat dey round mi; e bi like sey dem go soon distroy mi. 22:6 Deat really dey around mi and grave set trap for mi. 22:7 Wen I dey trobol, I koll Oga God; I koll my God make E help mi. E hear my vois for en temple kon listin and help mi wen I dey kry. 22:8 Den di eart bigin shake dey fear, di sky foundashon bigin shake too, bikos God bin dey vex! 22:9 Smoke dey kom out from en nose, while fire and shako dey kom out from en mout. 22:10 E tear di sky open kon kom down with one black kloud for en leg. 22:11 E dey fly with en shariot for heaven; E dey travel with di wind. 22:12 E kover ensef with darkness and tick kloud wey wota full dey round am. 22:13 Shako with fire dey kom out for en front. 22:14 Oga God dey bring tonda from di sky and evritin dey hear wen God wey get pawa dey tok. 22:15 E shot en arrow take skata en enemies. E use strong lite take make dem run. 22:16 Di river dry finish and di eart foundashon kon open so God nor keep silent and E kon shaut for en enemies with vexnashon. 22:17 God kom down from heaven kon hold mi. E draw mi komot from di wota wey deep well-well. 22:18 E save mi from my strong enemies and all di pipol wey hate mi, bikos dem too strong for mi. 22:19 Wen I dey trobol, dem attack mi, but God protet mi. 22:20 Bikos E dey happy with mi, E help mi wen I dey trobol kon save mi. 22:21 God reward mi, bikos I do wetin dey rite. E bless mi, bikos I dey innocent. 22:22 I don obey God law; I neva turn from my God before. 22:23 I don keep all en laws; I neva disobey en kommand. 22:24 E know sey I nor get fault and I nor dey do bad tins. 22:25 So E reward mi, bikos I dey do wetin dey rite, bikos E know sey I dey innocent. 22:26 My Oga God, Yu dey faithful to doz wey dey faithful to Yu and Yu dey good to pipol wey dey good. 22:27 Yu dey pure to doz wey dey pure, but Yu show wikedness to wiked pipol. 22:28 Yu dey save pipol wey dey honbol, but Yu dey honbol pipol wey dey proud. 22:29 Oga God! Na Yu bi my lite; Yu don remove my darkness. 22:30 Yu give mi pawa take attack my enemies kon ovakom dem. 22:31 Di tins wey dis God dey do, dey pafet. Make wi trust en words! E dey kover pipol wey wont make E protet dem. 22:32 Na di Oga bi God and na only God dey defend us. 22:33 Na inside God I hide put; E dey make my road save. 22:34 E make my foot dey save like deer kon keep mi save for di mountin. 22:35 E dey train mi for war, so dat I go use di bow wey strong well-well. 22:36 My Oga God! Yu protet and save mi; Yu don make mi great. 22:37 Yu keep mi, so dat dem nor go katch mi and I nor fall. 22:38 I porshu and defeat my enemies; I nor stop till I distroy dem finish. 22:39 I nak dem fall and dem nor fit stand again, bikos I defeat dem. 22:40 Yu give mi pawa for war and viktory ova my enemies. 22:41 Yu dey make my enemies run from mi and I distroy doz wey hate mi. 22:42 Dem dey look for help, but nobody dey to save dem. Dem koll God, but E nor ansa dem. 22:43 I skata and turn dem to san. I dey waka on-top dem like mud for street. 22:44 Yu save mi from my own pipol wey fight mi kon make mi dey always rule di nashons and even pipol wey I nor know, dey under mi. 22:45 Doz wey kom from anoda land dey bow for mi and wen dem si mi, dem dey obey. 22:46 Anywhere wey dem hide put, dem dey run komot der, bikos dem dey fear. 22:47 God go dey forever! Make wi praiz di Pesin wey dey defend mi! Make una tok how God wey save mi strong rish! 22:48 E give mi viktory ova my enemies kon put di nashons under mi. 22:49 My Oga God! Yu save mi from my enemies kon give mi viktory and protet mi from wiked men. 22:50 So, I dey praiz Yu among all di nashon; I go sing praiz Yu. 22:51 God dey give en king great viktory. E dey always show love to di pesin wey E choose and na mi, David with my shidren-shidren go rule forever.”