2 Samuel 4
4:1 Wen Saul pikin, Ish-Boshet hear sey dem don kill Abner for Hebron, fear katch am well-well and dem kon tell evribody for Israel.
4:2 Ish-Boshet get two ofisas; Baanah and Rekab wey bi leaders for war and dia papa na Rimmon from Beerot wey dey Benjamin tribe.
4:3 Di pipol wey get dat land don run go Gittaim and dem don dey stay der since.
4:4 Mefiboshet wey bi Jonatan pikin and Saul grand-pikin, na five years e bi wen di news kom from Jezrel sey dem don kill en grand-papa Saul and Jonatan en papa for war. Den en nurse kon karry am dey run, but bikos e dey hurry, di pikin fall from en hand, so en leg kon break.
4:5 Rekab and Baanah go Ish-Boshet house for aftanoon wen e dey rest.
4:6 Di pesin wey dey di door don sleep go as e dey pick dirty komot for wheat, so Rekab and Baanah kon waka small-small enter di house.
4:7 At wons, dem enter Ish-Boshet room kon kill-am. Den dem kut en head, karry follow body kon waka for nite pass Jordan River Valley.
4:8 Dem give di head to David for Hebron kon sey, “Ish-Boshet wey bi Saul pikin; yor enemy wey won kill yu, na en head bi dis. Today, God don allow di king revensh Saul and en shidren-shidren.”
4:9 David kon ansa dem, “As long as di God wey save mi from all danger dey alive,
4:10 even di messenja wey kom meet and tell mi for Ziklag sey Saul don die tink sey e dey bring good news kom give mi. I whole and I kill-am. Dat na di reward wey I gi-am for en good news!
4:11 Not to tok about una wey do evil kon go kill pesin wey dey sleep for en own house! I go take revensh and as una kill-am, na so una go take die too!”
4:12 Den David orda en sojas and dem kill dem. Dem kut dia hand and leg komot kon hang dem near Hebron wotaside. But dem take Ish-Boshet head kon go beri am for Abner grave for Hebron.