2 Samuel 8
8:1 Afta sometaim, King David attack Filistia pipol again, e win dem kon take dia land wey bi Meteg Ammah from dia hand.
8:2 E win Moab pipol too. E make dem liedan for groun kon divide dem group by group and for evry three group, e kill two. So Moab pipol kon dey work and pay dia tax give David.
8:3 David still win King Hadadeza wey Rehob bi en papa, wey dey rule Siria for Zobah wen King Hadadeza dey go take-ova Uppa Eufrates for di river aria.
8:4 David seize 1,000 seven hundred horse-men and 20,000 sojas wey dey waka for groun. E keep like one hundred horse kon cripple di rest.
8:5 Wen Siria pipol for Damaskus send sojas go help Hadadeza, David attack and kill 22,000 of dem.
8:6 Den e build soja kamp for dia aria and dem kon dey pay dia tax to am. God make David win for evriwhere.
8:7 Di gold shield wey Hadadeza take dey guide ensef, David karry am go Jerusalem.
8:8 E still take plenty bronze from Tebah and Berotai towns wey Hadadeza dey rule.
8:9 King Toi for Hamat hear sey David don defeat Hadadeza sojas.
8:10 So e send Joram en pikin make e go kongratulate David for en viktory against Hadadeza wey King Toi don fight many times.
8:11 David dedikate di silva and gold wey e bring from di nashons wey e win and dem use dem take serve God.
8:12 E win Edom, Moab, Ammon, Filistia and Amalek pipol and e still karry tins from Hadadeza.
8:13 David kon popula well-well afta e just kom back from where e for go kill 18,000 Edom pipol for Salt Valley.
8:14 E build soja kamp for evriwhere for Edom and di pipol for der kon dey under en pawa. God make David win for evriwhere.
8:15 David rule evriwhere for Israel and e make sure sey dem trit evribody well with betta mind.
8:16 Joab wey en mama name na Zeruaya, naim dey kommand di sojas, while Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, dey keep rekord.
8:17 Zadok wey bi Ahitub pikin and Ahimelek wey bi Abiatar pikin, na dem bi priests. Na Seraya bi di kourt seketry.
8:18 Benaya wey bi Jehoiada pikin, naim bi David bodyguard oga. David sons na priests too.