2 Kings 21
21:1 Manasseh na twelf years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for fifty-five years. En mama name na Hepzibah.
21:2 E nor gri obey God and e kon dey sin like di oda kountries wey God drive komot der.
21:3 E ribuild di high place dem wey en papa Hezekaya bin distroy; e build altars for Baal juju kon make Asherah juju, just as King Ahab do for Israel. E dey bow and woship stars for sky.
21:4 E build juju altar for God Temple, even wen God don sey, “Jerusalem na my house.”
21:5 For di two kourtyard wey dey God Temple, e build altar for all di stars wey dey di sky.
21:6 E dey sakrifice en sons and dey do majik. E dig one pit where dem for dey koll dead body spirit kom out kon choose majik men make dem dey look am. Di bad-bad tins wey e do many well-well for God eye, so God kon dey vex.
21:7 E put Asherah juju wey e make for di temple, di place where God don tell David and en pikin, Solomon sey, “Dis temple for Jerusalem wey I don choose from all di tribes for Israel, go bi where I go stay forever.
21:8 I nor go porshu Israel pipol from dis land wey I don give to dia grand-grand papa, as long as dem obey all di kommand and laws wey I give dem thru Moses, my savant.”
21:9 But dem nor gri obey and Manasseh make all of dem bigin sin pass di kountries wey God distroy bikos of Israel pipol.
21:10 So God kon tok thru en savant di profet sey:
21:11 “King Manasseh for Judah don sin well-well, E don sin pass Amor pipol wey dey here before and e don enkourage Judah pipol to sin as dem dey serve all dis yeye juju.
21:12 So dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok, ‘I go kause wahala for Jerusalem and Judah pipol. And e go shok anybody wey go hear wetin happen.
21:13 As I take distroy Samaria and Ahab generashon, na so too I go distroy Jerusalem. I go make sure sey nor-tin dey for Jerusalem again and e go bi like plate wey dem wosh klean.
21:14 Di tribe wey remain among my pipol, I go forget dem kon give dem to dia enemies wey go beat and tif dia propaty,
21:15 bikos dem don sin against mi kon make mi dey vex since wen dia grand-grand papa komot from Egypt kon rish naw!’ ”
21:16 Manasseh still kill many innocent pipol and dia blood don stain Jerusalem from one end go rish di oda end. E even still dey enkourage Judah pipol to sin against God.
21:17 Di remainin tins wey Manasseh do, plus all wetin e get and di sins wey e kommit, dem rite dem put for Judah kings history book.
21:18 Manasseh die and dem beri am for Uzza gardin wey dey en palis and en pikin, Amon kon take-ova as king.
21:19 Amon na twenty-two years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for two years. En mama name na Meshullemet and na Haruz wey kom from Jotbah, born di woman.
21:20 E nor gri obey God kommand, but e sin like en papa Manasseh.
21:21 E dey do like en papa, bikos en too dey woship and bow to yeye gods and juju wey en papa woship.
21:22 E nor gri follow en grand-grand papa dem Oga wey bi God or listin to en kommand.
21:23 Amon savants kon plan and kill-am for en palis.
21:24 Di pipol for di land kon kill all doz wey plan kill King Amon, den dem kon make en pikin Josaya, king for Judah.
21:25 Di remainin tins wey Amon do, plus all wetin e get, dem rite am put for Judah kings history book.
21:26 Dem beri am for en own grave for Uzza gardin and en pikin Josaya kon take-ova as king.