Library · pcm

1 Chronicles 1

1:1 Na Adam born Seth, Seth born Enosh, Enosh born Kenan 1:2 and na Kenan born Mahalalel. Na Mahalalel bi Jared papa. 1:3 Jared born Enoch, Enoch born Metuselah, Metuselah kon born Lamek. 1:4 Lamek born Noah, Noah born Shem, Shem born Ham and na Ham born Jafet. 1:5 Jafet shidren na: Gomer, Magog, Madai, Javan, Tubal, Meshak and Tiras. 1:6 Gomer shidren na: Ashkenaz, Difat and Togarmah. 1:7 Javan shidren na: Elisha, Tarshish, Kittite and Rodan. 1:8 Ham shidren na: Kush, Mizraim, Put and Kanaan. 1:9 Kush shidren na: Seba, Havilah, Sabteka, Rama and Sabtah. Rama shidren na: Sheba and Dedan. 1:10 Na Kush born Nimrod and Nimrod kon bi di first pesin wey strong well-well for di world. 1:11 Na Mizraim born Lud, Anam, Lehab, Naftuh, 1:12 Patrus, Kasluh, Krete (wey Filistia pipol from kom) and Kaftor pipol too. 1:13 Na Kanaan bi Sidon and Het papa, but na Sidon bi en first pikin. 1:14 Na Kanaan still born Jebus, Amor, Girgash, 1:15 Hiv, Ark, Sin, 1:16 Arvad, Zemar and Hamat pipol. 1:17 Shem shidren na: Elam, Asshur, Arfaxad, Lud and Aram. Aram shidren-shidren na: Uz, Hul, Geta and Meshak. 1:18 Na Arfaxad born Shelah and na Shelah bi Eber papa. 1:19 Eber born two pikin: one name na Peleg (wey mean divide), bikos e born am for di time wen God take divide and make pipol dey speak difren language for di world. Di oda pikin name na Joktan. 1:20 Joktan shidren na Almodad, Shelef, Hazar-Mavet, Jerah, 1:21 Hadoram, Uzal, Diklah, 1:22 Ebal, Abimael, Sheba, 1:23 Ofir, Havilah and Jobab pipol. 1:24 Na Shem and Abram family pipol bi dis: Shem, Arfaxad, Shelah, 1:25 Eber, Peleg, Reu, 1:26 Serug, Nahor, Terah 1:27 and Abram wey God shange en name to Abraham. 1:28 Abraham born two sons: Isaak and Ishmael. 1:29 Dis na dia shidren-shidren: Na Nebaiot bi Ishmael first pikin, before e kon born Kedar, Adbeel, Mibsam, 1:30 Mishma, Dumah, Massa, Hadad, Tema, 1:31 Jetur, Nafish and Kedemah. Na Ishmael shidren dem bi. 1:32 Keturah wey bi Abraham girl-friend, na-im born Zimran, Jokshan, Medan, Midian, Ishbak and Shuah. Na Jokshan born Sheba and Dedan. 1:33 Midian shidren na Efah, Efer, Hanok, Abidan and Eldaah. All dis pipol na Keturah sons. 1:34 Na Abraham bi Isaak papa. Isaak shidren na: Esau and Jakob (wey God shange en name to Israel). 1:35 Esau shidren na: Elifaz, Reuel, Jeush, Jalam and Korah. 1:36 Elifaz shidren na: Teman, Omar, Zefi, Gatam, Kenaz, but Timna still born Amalek for am. 1:37 Reuel shidren na: Nahat, Zera, Shammah and Mizzah. 1:38 Seir shidren na: Lotan, Shobal, Zibeon, Anah, Dishon, Ezer and Dishan. 1:39 Lotan shidren na: Hori and Homam (and Timna, na Lotan sista). 1:40 Shobal shidren na: Alvan, Manahat, Ebal, Shefi and Onam. Zibeon shidren na: Aiaya and Anah. 1:41 Anah son na Dishon. Na Dishon born Hamran, Eshban, Itran and Keran. 1:42 Ezer shidren na: Bilhan, Zaavan, Jaakan. Na Dishan born Uz and Aran. 1:43 Na di kings wey rule Edom land before any king rule Israel pipol bi dis. Bela wey Beor born and e kom from Dinhabah. 1:44 Wen Bela die, Jobab wey bi Zera pikin wey kom from Bozrah kon take-ova as king. 1:45 Wen Jobad die, Husham wey kom from Teman land kon take-ova as king. 1:46 Wen Husham die, Hadad wey Bedad born kon take-ova as king and e rule from Avit town. E win Midian pipol for war for Moab. 1:47 Wen Hadad die, Samlah wey kom from Masrekah kon take-ova as king. 1:48 Wen Samlah die, Shaul wey kom from Rehobot near di river kon take-ova as king. 1:49 Wen Shaul die, Baal-Hanan wey Akbor born kon take-ova as king. 1:50 Wen Baal-Hanan die, Hadad wey kom from Pau kon take-ova as king. En wife name na Mehetabel, wey bi Matred pikin and na Me-Zahab bi Matred mama. 1:51 Hadad kon die. Di shief for Edom tribe na: Timna, Alvah, Jetet, 1:52 Oholibama, Elah, Pinon, 1:53 Kenaz, Teman and Mibzar, 1:54 Magdiel and Iram. All dis na dis na Edom shiefs.