Library · pcm

1 Chronicles 11

11:1 Den all Israel pipol go meet David for Hebron kon tell am, “Wi bi yor own flesh and blood. 11:2 Before-before, even wen Saul still bi awa king, yu karry us go fight and God wey bi yor God promise yu sey, yu go lead en pipol as dia king.” 11:3 Wen di leaders for Israel meet David for Hebron, e make agriment with dem and dem anoint am as king for Israel, just as God promise dem thru Samuel. 11:4 David and Israel pipol go attack Jerusalem. Dat time, dem dey koll Jerusalem, “Jebus”, bikos na Jebus pipol dey stay di land. 11:5 Jebus pipol kon tell David sey e nor go fit enter di town, but David seize where God propaty dey for Zion, so dem kon dey koll di place, “David Town.” 11:6 David sey, “Di first man wey go attack Jebus pipol, na-im go bi di sojas oga!” So Joab wey en mama na Zeruaya, first attack and kill dem, so e kon bi di sojas oga. 11:7 David go stay for where dia betta propaty dey and na dis make dem dey koll am, David Town. 11:8 David build di town again. E start from where big land dey for di east for di hill and Joab kon build di remainin side. 11:9 David kon dey strong evriday, bikos di Oga God dey with am. 11:10 Dis na David strong sojas wey help and make en kingdom stand for Israel. 11:11 Dia names na: Jeshobeam wey kom from Hakmon tribe and naim dey head di ofisas. E kill three hundred men with en spear for only one war. 11:12 Di next one na Dodo pikin, Eleazar wey kom from Ahohi tribe. 11:13 E follow David fight Filistia pipol for Pass Dammim. E dey one side for di field wey barley full, even wen Israel pipol bigin run, 11:14 en and en men dey di field centre kon fight Filistia pipol and God make dem win. 11:15 One day, three of en strong sojas among di thirty kon go one rock where David dey stay near Adullam Kave, while some Filistia pipol dey Refah Valley. 11:16 For dat time, David dey one hill wey dem guide well-well and some Filistia pipol dey for Betlehem. 11:17 David dey hongry for wota so e kon sey, “I wish pesin fit go draw wota kon give mi from di well wey dey for Betlehem gate, so dat I go drink!” 11:18 Di three strong sojas kon force diasef pass Filistia pipol kamp, draw wota from di well kon give David. But e nor gri drink am, instead, e pour am for groun as ofrin to God 11:19 kon sey, “I nor fit drink dis wota, bikos e go bi like sey I dey drink dis men wey risk dia life, blood!” So e nor drink am. So dis na wetin di three strong sojas do. 11:20 Na Joab broda, Abishai dey lead di three strong sojas. E use en spear take fight three hundred men kon kill all of dem, den e kon dey popula with di three strong sojas. 11:21 Na-im popula pass among “Di Three” and e kon bi dia leader, even doh e nor dey join di three. 11:22 Jehoiada pikin Benaya wey kom from Kabzeel, na anoda strong soja. E still do many big tins kon kill two strong men for Moab. One day, e enter one pit go kill lion. 11:23 E kill one Egypt man wey hold big spear for hand and tall rish seven and half fit. Benaya attack di man, kollect en spear kon kill-am. 11:24 Dis na di strong tin wey Benaya do and e dey among, “Di Thirty.” 11:25 Among di thirty, naim popula pass, but dem nor know am rish di three strong sojas. David kon make am di bodyguards oga. 11:26 Di oda sojas wey do well na: Asahel wey bi Joab broda; Elhanan wey bi Dodo pikin wey kom from Betlehem; 11:27 Shammot wey kom from Harod; Helez wey kom from Pelon; 11:28 Ikkesh pikin, Ira wey kom from Tekoa; Abiezer wey kom from Anatot; 11:29 Sibbekai wey kom from Hushah; Ilai wey kom from Ahohi; 11:30 Maharai wey kom from Netofat; Baanah pikin, Heled wey kom from Netofat; 11:31 Ribai pikin, Itai wey kom from Gibeah for Benjamin aria; Benaya wey kom from Piraton; 11:32 Hurai wey kom from Gaash Valley; Abiel wey kom from Arbat; 11:33 Azmavet wey kom from Bahurim; Eliahba wey kom from Shaalbon, 11:34 Hashem wey Gizon born; Shagee pikin, Jonatan wey kom from Harar; 11:35 Sakar pikin, Ahiam wey kom from Harar; Elifal wey Ur born; 11:36 Hefa wey kom from Mekera; Ahijah wey kom from Pelon; 11:37 Hezro wey kom from Karmel; Naarai wey kom from Ezbai; 11:38 Joel wey bi Natan broda; Mibhar wey Hagri born; 11:39 Zelek wey kom from Ammon; Naharai wey kom from Beerot. Na dis Naharai dey hold Zeruaya pikin, Joab swod. 11:40 Ira with Gareb wey kom from Jattir; 11:41 Uriaya wey kom from Hit; Zabad wey Ahlai born. 11:42 Shiza pikin, Adina wey kom from Reuben tribe and di thirty sojas; 11:43 Hanan wey Maaka born; Joshafat wey kom from Mitnite; 11:44 Uzzia wey kom from Ashterah; Shama and Jeiel, Hotam shidren wey kom from Aroer tribe; 11:45 Jediael wey Shimri, en broda Joha wey kom from Tiz born; 11:46 Eliel wey kom from Mahavah; Jeribai and Joshavaya wey bi Elnaam shidren; Itmah wey kom from Moab tribe. 11:47 Den Eliel, Obed and Jaasiel wey kom from Mezoba.