1 Chronicles 23
23:1 Wen David don old well-well, e kon make en pikin Solomon, king for Israel.
23:2 David gada Israel leaders, di priests and Levi pipol togeda
23:3 kon kount all di men wey kom from Levi tribe wey don rish or pass thirty years and all of dem na, 38,000.
23:4 Di king choose 24,000 wey go do di temple work; 6,000 wey go dey rite and judge kase;
23:5 4,000 wey go dey guide and anoda 4,000 wey go dey praiz God with di music instrument wey di king make.
23:6 David divide Levi pipol into three groups, just as dem take kom from Gershon, Kohat and Merari family.
23:7 Gershon born two sons: Ladan and Shimei.
23:8 Ladan three son na: Jehiel, Zetam and Joel.
23:9 Shimei three sons na: Shelomot, Haziel and Haran. Na dem dey lead Ladan family.
23:10 Shimei still born: Jahat, Ziza, Jeush and Beraya.
23:11 Na Jahat dey lead di family sekond to Ziza. Jeush and Beraya nor born many sons, so dem kount dem as one family.
23:12 Kohat born four sons: Amram, Izhar, Hebron and Uzziel.
23:13 Na Amram born Aaron and Moses. Dem choose Aaron and en shidren-shidren to dey kare for di holy tins; burn incense to take woship God; to dey serve God and dey bless di pipol with God name forever.
23:14 But Moses wey bi God savant, dem rite en shidren-shidren name join Levi pipol.
23:15 Moses born two sons: Gershom and Elieza.
23:16 Na Shebuel bi Gershom first son.
23:17 Elieza born only Rehabaya, but Rehabaya born many shidren.
23:18 Na Kohat sekond pikin, Izhar born Shelomit.
23:19 Hebron four sons na: Jeraya, Amaraya, Jahaziel and Jekameam.
23:20 Uzziel sons na: Mikah and Isshaya.
23:21 Merari sons na: Mahli and Mushi. Mahli sons na: Eleazar and Kish.
23:22 But Eleazar nor get boy pikin before e die, na only girls e born. En girl shidren marry Kish shidren wey bi dia kousin.
23:23 Mushi born three sons: Mahli, Eda and Jerimot.
23:24 Na Levi shidren-shidren bi dis, just as dem rite dia name for dia difren family. Doz wey don rish twenty years for Levi family, still follow dem work for God Temple.
23:25 Den David sey, “Di Oga wey bi Israel God don give en pipol rest and E go stay Jerusalem forever.
23:26 So, Levi pipol nor nid to dey karry di tent wey God dey and all di tins wey dem take dey woship am, again.”
23:27 Just as David kommand, dem kon kount Levi pipol wey don rish and pass twenty years.
23:28 Dia work na to help Aaron shidren-shidren as dem dey serve for God Temple. Na dem dey kare for di kourtyard; di rooms; to dey klean di holy tins and any oda tin wey koncern God Temple.
23:29 Na dem still dey kare for di bread wey dey der; di ofrin flour; di bread wey nor get yist; to dey mix dem and all di tins wey dem dey measure.
23:30 Dem still dey stand for one special place evry morning and evening dey offa tanks and praiz to God,
23:31 both for di time wen dem burn sakrifice as ofrin to God on Sabat Day and for New Moon Feast. E get di nomba of pipol wey must serve God evritime, just as dem rite am for di law.
23:32 Na dem dey kare for di tent where dem for dey meet and di holy place. Dem still dey help dia brodas wey bi Aaron shidren-shidren, wey dey serve for God Temple.