1 Chronicles 3
3:1 Dis na shidren wey dem born for David wen e dey Hebron: Di first pikin na Amnon, en mama na Ahinoam wey kom from Jezrel: di sekond one na Daniel, en mama name na Abigail, wey kom from Karmel.
3:2 Di third one na Absalom, en mama name na Maaka and na Talmai wey bi Geshur king, born am; di next one na Adonijah and na Haggit bi en mama;
3:3 Shefataya na di fift one and en mama name na Abital; Itream wey en mama name na Eglah, na-im bi di sixt one.
3:4 Dis na di six shidren wey dem born give David for Hebron where e for rule for seven years and six monts. E rule Jerusalem for thirty-three years:
3:5 Shimea, Shobab, Natan and Solomon na di sons wey dem born give David for Jerusalem and na Batsheba wey bi Ammiel pikin, bi dia mama.
3:6 David oda nine shidren na: Ibhar, Elishua, Elifelet,
3:7 Nogah, Nefeg, Jafia,
3:8 Elishama, Eliada and Elifelet.
3:9 Na David sons bi dis, dem nor kount di sons wey en girl-friends born for am. Tamar na dia sista.
3:10 Solomon born Rehoboam, Rehoboam born Abijah, Abijah born Asa wey born Jehoshafat,
3:11 Jehoshafat born Joram, Joram born Ahazaya and Ahazaya born Joash.
3:12 Joash born Amazaya wey born Zabud; Zabud born Jotam and Jotam kon born Ahaz.
3:13 Ahaz born Hezekaya; na Hezekaya born Manasseh and na Manasseh bi Amnon papa.
3:14 Amon na Josaya papa.
3:15 Josaya sons na: Johanan, Jehoiakim, Zedekaya and Shallum.
3:16 Jehoiakim sons na: Jehoiashin and Zedekaya.
3:17 Jehoiashin sons wey Babilon pipol karry go prison na: Shealtiel,
3:18 Malkiram, Pedaaya, Shenazzar, Jekamaya, Hoshama and Nedabaya.
3:19 Pedaaya shidren-shidren na: Zerubabel and Shimei. Na Meshullam and Hananaya bi Zerubabel shidren and na Shelomit bi dia sista.
3:20 Zerubabel oda five shidren na: Hashubah, Ohel, Berakaya, Hasadaya and Jushab-Hesed.
3:21 Hananaya shidren-shidren na: Pelataya and Jeshaya. Jeshaya born Refaaya wey bi Arnan papa and na Arnan born Obadaya wey bi Shekanaya papa.
3:22 Shekanaya born only Shemaya and Shemaya sons na: Hattush, Igal, Baraya, Nearaya and Shafat. All of dem na six.
3:23 Nearaya three sons na: Elioenai, Hezekaya and Azrikam.
3:24 Elioenai get seven sons and dem bi: Hodevah, Eliashib, Pelaaya, Akkub, Johanan, Delaaya and Anani.