1 Chronicles 5
5:1 Reuben wey bi Jakob first pikin, na en shidren-shidren bi dis. But bikos e sleep with en papa wife, di papa kon give en senior pozishon to Josef. So for dia family history, dem nor rite Reuben as di first-born.
5:2 Bikos na Judah strong pass, dem kon make am leader among en brodas, but na Josef dem still take as first pikin.
5:3 Reuben wey bi Jakob first pikin, en four sons na: Hanok, Pallu, Hezron and Karmi.
5:4 Joel shidren-shidren na: Shemaya, Gog, Shimei,
5:5 Mikah, Reaaya, Baal and
5:6 Beerah wey bi leader for Reuben tribe wey Tilgat-Pilneser, Assyria king karry go anoda land.
5:7 Dis na di names wey dem rite for di family: Jeiel, Zekaraya
5:8 and Bela wey Azaz born and na Shema wey kom from Joel tribe, bi en grand-papa. Dis tribe dey stay for Aroer go rish Nebo and Baal-Meon.
5:9 Bikos dem get many animals for Gilead land, dem kon spread face east for di wildaness side go rish Eufrates River.
5:10 For di time wen Saul bi king, Reuben tribe attack and kill Hagrit pipol for war, den dem take dia land for di east side for Gilead.
5:11 Gad tribe stay from Bashan land near Reuben tribe land go rish Salekah wey dey di east.
5:12 Na Joel dey lead dem, sekond to Shafam, before Janai and Shafat.
5:13 Di oda seven membas akordin to dia family na: Mikael, Meshullam, Sheba, Jorai, Jakan, Zia and Eber.
5:14 And dia grand-grand papa dem na: Abihail wey Huri born, wey Jaroah born, wey Gilead born, wey Mikael born, wey Jeshishai born, wey Jahdo wey bi Buz pikin, born.
5:15 Na Guni pikin, Abdeil born Ahi wey bi leader for dis family.
5:16 Dem dey stay for Bashan and Gilead aria and all di good land wey dey Sharon.
5:17 (Dem rite all dis tins wen King Jotam dey rule for Judah and King Jeroboam dey rule for Israel.)
5:18 Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe get 44,760 sojas and dem don train dis men well-well on how to dey guide, use swod and shot arrow.
5:19 Dem go fight Hagrit, Jetur, Nafish and Nodab pipol.
5:20 Dem ask and pray to God make E help dem and God ansa dia prayers kon make dem win di war.
5:21 Dem katch 50,000 kamel; 250,000 sheep; 2,000 donkey and 100,000 men as prisonas from dia enemies.
5:22 Dem kill many enemies, bikos God fight for dem. So dem kon dey stay dat aria until dem karry dem go Babilon as slaves.
5:23 Di pipol wey dey half of Manasseh tribe kon stay from Bashan go rish Baal-Hermon, Senir and Mount Hermon and dem kon dey many well-well.
5:24 Di leaders for dia family na: Efer, Ishi, Eliel, Azriel, Jeremaya, Hodevah and Jahdiel. All of dem na strong sojas wey pipol know well-well for di land.
5:25 Di God wey dia grand-grand papa woship, dem nor gri obey en kommand, instead di nashons wey God porshu komot di land, Israel pipol kon dey woship dia juju.
5:26 So God make King Pul for Assyria (wey dem still dey koll Tilgat-Pilneser) attack dia kountry. E karry Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe go stay for Halah, Habor, Hara and Gozan River and na der dem dey till today.