Library · pcm

1 Chronicles 8

8:1 Benjamin first son na Bela, sekond to Ashbel, before Ahara, 8:2 Nohah and Rafa. 8:3 Bela shidren-shidren na: Addar, Gera, Abihud, 8:4 Abishua, Naaman, Ahoah, 8:5 Gera, Shefufan and Huram. 8:6 Dis na Ehud shidren-shidren. Dem bi di head for dia family and na Gibeah dem dey stay, but dem force dem go stay for Manahat. 8:7 Ehud shidren na Naaman, Ahijah and Gera. Gera, wey bi Uzza and Ahihud papa, na-im lead dem for di journey. 8:8 Afta Shaharaim porshu en too wifes, Hushim and Baara, e still born shidren wen e dey Moab land. 8:9 E marry Hodesh wey born seven sons for am and dia names na: Jobab, Zibia, Mesha, Malkam, 8:10 Jeuz, Sakia and Mirmah. All en shidren na leaders for dia family. 8:11 Hushim still born two sons for am: Abitub and Elpaal. 8:12 Elpaal born three sons: Eber, Misham and Shemed. Na Shemed build Ono and Lod town with all di village wey dey near am. 8:13 Beraya and Shema na leaders for dia family and dem go stay for Aijalon kon porshu doz wey dey stay for Gat town komot. 8:14 Beraya shidren na: Ahio, Shashak, Jerimot, 8:15 Zebadaya, Arad, Eder, 8:16 Mikael, Ishpah and Joha. 8:17 Elpaal shidren na: Zebadaya, Meshullam, Hizki, Heba, 8:18 Ishmerai, Izlaya and Jobab. 8:19 Shimei shidren na: Jakim, Zikri, Zabdi, 8:20 Elienai, Zilletai, Eliel, 8:21 Adaya, Beraaya and Shimrat. 8:22 Shashak shidren na: Ishpan, Eber, Eliel, 8:23 Abdon, Zikri, Hanan, 8:24 Hananaya, Elam, Antotijah, 8:25 Ifdeaya and Penuel. 8:26 Jeroham shidren na: Shamsheraya, Sheharaya, Atalaya 8:27 Jaareshaya, Elijah and Zikri. 8:28 All dis na di leaders for di family with dia shidren-shidren for Jerusalem just as dem rekord am. 8:29 Na Jeiel build Gibeon town. En wife na Maaka 8:30 and en first pikin name na Abdon, sekond to Zur, before Kish, Baal, Ner, Nadab, 8:31 Gedor, Ahio, Zeka 8:32 and Miklot wey bi Shimea papa. All dis family stay for Jerusalem near dia oda family pipol. 8:33 Na Ner bi Kish papa and na Kish born King Saul. Saul born four sons: Jonatan, Malki-Shua, Abinadab and Eshbaal. 8:34 Na Jonatan bi Meribbaal papa and Merib-Baal born Mikah. 8:35 Mikah born four sons: Piton, Melek, Tarea and Ahaz. 8:36 Ahaz na Jehoaddah papa and Jehoaddah born three sons: Alemet, Azmavet and Zimri. Na Zimri bi Moza papa. 8:37 Na Moza born Binea, Binea born Rafah wey bi Eleasah papa and na Eleasah born Azel. 8:38 Azel born six sons: Azrikam, Bokeru, Ishmael, Shearaya, Obadaya and Hanan. 8:39 Azel broda, Eshek born three sons: Ulam, Jeush and Elifelet. 8:40 Ulam sons na strong sojas. En shidren with en grand-shidren, na 150 dem bi. Na dis pipol bi Benjamin shidren-shidren.