Ezra 1
1:1 For di first year wey King Cyrus for Persia dey rule, God make wetin E tok thru Profet Jeremaya happen. E make King Cyrus rite, send and read dis kommand for evriwhere for en kingdom, so dat evribody go hear:
1:2 Dis na wetin King Cyrus for Persia tok, Di Oga God for heaven don make mi rule di whole world and E sey make I build temple for am for Jerusalem wey dey Judah.
1:3 Make God dey with all of una wey bi en pipol as una dey go Jerusalem go ribuild di Oga wey bi Israel God house and na-im una go woship for Jerusalem.
1:4 Anywhere wey Israel pipol still remain, make dia neighbours help dem. Make dem give dem silva, gold, animals and ofrin wey dem go offa for God Temple for Jerusalem.
1:5 Di head for each family for Judah and Benjamin tribe, di priests, Levi pipol and evribody wey God tosh dia heart kon go back to Jerusalem go build God Temple.
1:6 All dia neighbours give dem tins like gold, silva pot, food, animals, oda betta tins and ofrin wey dem go use take ribuild God Temple.
1:7 King Cyrus bring di basins and cups wey King Nebukadnezzar take from God Temple for Jerusalem kon put dem for en own gods temple.
1:8 E give dem to Mitredat, di oga wey dey hold di palis money and e kount evritin give Sheshbazzar wey bi di govnor for Judah.
1:9 Di tins wey e kount na: 30 gold basin and 1,000 silva basin for ofrin and 29 oda basin.
1:10 Di oda tins na 30 small gold basin, 410 small silva basin and di oda tins to take kook, na 1,000.
1:11 Evritin kon bi 5,400 gold, silva and oda tins and Sheshbazzar karry dem follow body as en and di pipol dey komot from Babilon go Jerusalem.