Job 29
29:1 Job still sey:
29:2 “If to sey my life go fit bi as e bi before wen God dey look and guide mi!
29:3 Dat time, God always dey with mi and E dey give mi lite wen I dey waka for darkness.
29:4 Dat na di time wey evritin still dey well with mi. Den God goodness still dey protet my house.
29:5 Den God still dey with mi and all my shidren gada round mi.
29:6 My melu and goats dey give mi plenty milk and my olive tree dey grow for groun wey dry and strong.
29:7 Wen ever di town eldas dey meet and I go der,
29:8 yong boys dey stand as soon as dem si mi dey kom and old pipol dey stand greet mi with respet.
29:9 Di leaders wey dey lead di pipol go stop to tok.
29:10 Even di pesin wey dey important pass, go shut up for mi.
29:11 “Evribody wey hear from mi, dey praiz mi. Doz wey hear mi dey tok, go-go tok good about mi.
29:12 Wen poor pipol kry kom meet mi, I dey help dem; I dey help pikin wey nor get papa and mama and doz wey nor get where to go.
29:13 Doz wey dey face wahala, dey praiz mi and I dey protet and guide wimen wey dia husband don die.
29:14 I dey always do betta tin. Evritin wey I do dey always dey good.
29:15 Na mi bi blind pipol eye and doz wey nor fit waka, na mi bi dia leg.
29:16 I bi like papa to poor pipol and I dey setol matter even for doz wey I nor know.
29:17 I dey distroy wiked pipol pawa kon release di pesin wey dem katch.
29:18 “Den I sey, I go get long life kon die for my house without trobol.
29:19 I go bi like tree wey en rut get wota; wey dew dey wet en branches.
29:20 Evribody go dey praiz mi and my pawa nor go fail.
29:21 “Wen I dey advise pipol, dem dey kwayet listin to wetin I dey tok
29:22 and dem nor dey get anytin to tok wen I don tok finish. My word dey enter dia mind well.
29:23 Evribody dey welkom mi, just as farmer dey welkom rain wey won fall.
29:24 I dey smile give dem wey nor bilive diasef again and my betta face dey give dem hope.
29:25 I dey lead dem as king dey lead many pipol kon konfort dem wen dem dey face trobol.