Library · pcm

Psalms 100

100:1 Make evritin wey dey dis eart, shaut with joy to God! 100:2 Make una happy as una dey woship God. Make una sing with joy as una dey kom meet am. 100:3 Make una know sey na di Oga God bi God! Na-im make us and wi bi en pipol. Wi bi en pipol, di sheep wey dey en field. 100:4 So make una sing tanksgivin song as una dey enter en present! Make una enter en temple with tanksgivin. Make una tank and praiz en name. 100:5 Bikos God dey good, en love wey nor dey fail dey forever and E dey good from one generashon go rish anoda.