Library · pcm

Psalms 11

11:1 I bilive and trust sey God go protet mi. So wetin make yu dey sey, “Fly like bird go hide for mountin, so dat yu go dey save, 11:2 bikos wiked pipol dey wound innocent pipol anyhow. Dem hide for darkness dey shot good pipol with dia bow and arrow. 11:3 So, naw wey di foundashon don skata, wetin good pipol go fit do?” 11:4 But God dey for en holy temple; E dey rule from heaven. E dey look as evribody dey live dia life for dis eart. 11:5 God dey si both good and bad pipol. E hate doz wey love wahala. 11:6 E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze. 11:7 God dey good and E dey judge well; so E go favor doz wey dey do good too.