Library · pcm

Psalms 119

119:1 Make una si as God dey bless pipol wey dey do wetin dey rite and obey en kommand. 119:2 Pipol wey dey follow en rules kon find am with all dia heart, make una si as dia blessing many rish. 119:3 Dem nor dey do bad tins and dem always dey obey God word. 119:4 God sey make wi obey and keep yor kommand well-well. 119:5 If to sey I fit live my life just as Yu tok 119:6 den I nor go shame, bikos I dey follow wetin Yu tok. 119:7 As I dey learn evritin about yor raitiousness, I go tank Yu as I dey live my life as I suppose to live am! 119:8 I go obey yor laws, so my Oga God, make Yu nor taya for mi! 119:9 Di only way yong pesin go if live betta life, na to obey God word. 119:10 I don try well-well to find Yu. Abeg, make Yu nor let mi go against yor kommand. 119:11 I don keep yor word for my heart, so dat I nor go sin against Yu. 119:12 My God, I go praiz Yu, so make Yu tish mi yor laws. 119:13 I dey shaut and tok about all di kommands wey Yu give us. 119:14 Just as I dey happy to get propaty, na so too I dey happy to obey di laws wey Yu give us. 119:15 I go learn yor kommand kon study yor laws. 119:16 I go obey yor laws and I nor go forget yor word. 119:17 Make Yu dey good to mi wey bi yor savant, so dat I go live and obey yor word. 119:18 Make Yu open my eyes to si di wonderful tins wey dey yor law. 119:19 Na strenja I bi for dis world, so make Yu nor hide yor kommand from mi! 119:20 I always dey happy to dey learn yor rules and laws. 119:21 Yu porshu sturbon pipol; doz wey nor dey obey yor kommand and bikos of dis, curse dey dia head. 119:22 So make Yu nor let dem laf and curse mi, bikos I dey obey yor kommand. 119:23 Even doh important pipol sidan dey plan against mi, I go still dey tink of yor kommand, 119:24 bikos yor law dey sweet and dem dey give mi good advise. 119:25 I liedan dey roll for dust; so make Yu save mi with yor word. 119:26 I tell Yu about my problems and Yu ansa mi. Naw, make Yu tish mi yor laws. 119:27 Make Yu help mi undastand wetin yor kommandment mean and I go always dey tink about di wonderful tins wey Yu dey do. 119:28 Make Yu enkourage mi with yor word, so dat my pains nor go kill mi. 119:29 Make Yu nor let mi dey deceive mysef; but make Yu allow mi know yor ways. 119:30 I don choose to follow Yu; I don gri to live my life as yor word tok. 119:31 I hold yor laws well, so my God, make Yu nor let shame katch mi! 119:32 I go run follow yor kommands, bikos Yu dey make mi undastand life well-well. 119:33 My God, make Yu tish mi yor laws and I go obey dem till I die. 119:34 Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok kon learn dem with all my heart. 119:35 Make Yu let mi follow yor kommand, bikos na der my happiness dey. 119:36 Instead of to dey love money, make Yu let mi dey worry to know yor laws! 119:37 Make Yu help mi take my eyes komot from tins wey nor mean anytin and give mi life thru yor word. 119:38 Make Yu tell mi again about yor promise wey Yu make to di pipol wey dey fear and obey Yu. 119:39 Di tins wey dey make mi fear, make Yu take dem komot from my life, bikos yor law dey good. 119:40 I dey wait since to obey yor kommand, so make Yu make my life new again, bikos Yu good well-well. 119:41 My God, make Yu give mi yor love wey nor dey fail and di salvashon wey Yu promise mi. 119:42 Den I go fit ansa pipol wey dey won kill mi, bikos I trust yor word. 119:43 Make Yu nor take yor word komot from my mout, bikos na yor law dey give mi hope! 119:44 Den I go always dey obey yor laws forever and ever. 119:45 I go dey save, bikos na only yor kommand I dey follow. 119:46 I go speak to kings about yor laws and I nor go shame. 119:47 Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand! Si as I love dem well-well! 119:48 I honor and love yor kommand and I dey always tink of yor laws. 119:49 Make Yu remember di promise wey Yu make give mi, bikos na-im bi my only hope. 119:50 Yor promise dey revive and help mi wen I dey for trobol. 119:51 Na so-so laf wiked pipol dey laf mi, yet, I dey still obey yor laws. 119:52 My Oga God, I dey tink about yor laws wey dey since and dem dey konfort my soul. 119:53 I dey vex for wiked pipol, bikos dem rijet wetin Yu tok. 119:54 Anywhere wey I dey, na yor law bi di song wey I dey sing. 119:55 My God, for nite, I dey remember yor name and I dey obey yor kommand. 119:56 Na to obey yor kommand bi evritin wey I dey do for dis life. 119:57 Na Oga God dey guide and save mi! So I promise to always dey obey yor word! 119:58 I wont yor blessing with all my heart, so make Yu show mi mesi, just as Yu promise. 119:59 Wen I tink as my life bi naw, I kon choose to follow yor ways. 119:60 So, I go kwik-kwik dey do wetin Yu kommand. 119:61 Wiked pipol dey won drag mi enter sin, but yor word dey strong for my heart. 119:62 I dey wake-up for nite dey tank Yu, bikos of yor good laws. 119:63 Na pipol wey dey fear Yu bi my friends; doz wey dey obey yor kommand. 119:64 My God, yor love wey nor dey fail, full di world; so make Yu tish us yor laws! 119:65 My God, Yu don do many good tins for mi just as Yu promise! 119:66 I bilive yor kommand and naw, make Yu tish mi how to judge well and to undastand yor laws! 119:67 I bin dey sofa, bikos I waka live yor ways, but naw, I dey obey yor word. 119:68 Yu dey good and na only good tins Yu dey do; so make Yu tish mi yor kommand! 119:69 Wiked pipol lie full my ear, but I dey obey yor kommands with all my heart. 119:70 Dia heart dey empty and stupid, but I dey happy for yor kommand. 119:71 My pains dey good for mi, bikos e dey tish mi how to listin to yor kommand. 119:72 Yor kommand dey good to mi pass plenty silva and gold. 119:73 Na Yu make and kreate mi. Naw, make Yu give mi di sense to follow yor kommand. 119:74 Make pipol wey dey fear Yu, dey happy wen dem si wetin Yu do for mi, bikos I don put my hope for yor word. 119:75 My God, I know sey yor laws nor dey bad or hard. Yu dey ponish mi, bikos e dey good for mi. 119:76 Naw, make yor love wey nor dey fail, konfort mi, just as Yu promise mi wey bi yor savant. 119:77 Make Yu sorry for mi kon protet mi, so dat I nor go die, bikos na yor law dey make belle sweet mi. 119:78 Make Yu disgrace doz wiked pipol wey dey lie for my head; but I go always dey follow yor kommand. 119:79 Make Yu add mi join di pipol wey dey fear Yu; doz wey know yor laws. 119:80 As I dey keep yor kommand, make evritin wey I dey do, good for yor eye, so dat shame nor go katch mi. 119:81 I taya as I dey wait make Yu save mi, but I don put my hope for yor word. 119:82 My eye just dey look to si sey wetin Yu promise, dey happen. So wen Yu go kom help mi? 119:83 I bi like leda bag wey skwiz, bikos e dey where smoke full, yet I neva forget to obey yor kommandment. 119:84 So, na how long I go dey wait? Na wen Yu go ponish di pipol wey dey wahala mi? 119:85 Doz wiked pipol wey hate yor laws don dig pit to katch mi. 119:86 But all yor kommand dey good, so make Yu protet mi from di pipol wey just like to kill mi. 119:87 Even doh dem don nearly kill mi, I still dey obey yor kommands. 119:88 So make Yu save my life with yor love wey nor dey fail; den I go kontinue to obey yor laws. 119:89 My God, yor word wey dey forever, stand gidigba for heaven. 119:90 Yu dey good to all generashon and na as Yu kreate di eart, e still dey kon rish naw. 119:91 Evritin dey as dem dey kon rish today, bikos evritin dey work as Yu plan am. 119:92 If to sey yor laws nor keep mi with joy, I for don die with my pains. 119:93 I nor go ever forget yor kommand, bikos na dem Yu take dey give mi life. 119:94 I bi yor own, so make Yu save mi, bikos I don work well-well to obey yor kommand. 119:95 Even doh wiked pipol dey hide for road to kill mi, I kwayet as I keep yor laws for my mind. 119:96 Naw, I don know sey evritin get where dem fit do rish and evribody get where dem know rish, but nobody fit undastand yor kommandment finish. 119:97 My God, si as I love yor laws and I dey tink about dem evriday. 119:98 Yor kommandment make mi get sense pass my enemies, bikos na dem dey always guide mi. 119:99 Yes, I get betta undastandin pass my tishas, bikos I always dey tink of yor laws. 119:100 I even get sense pass my eldas, bikos I dey keep yor kommandment. 119:101 I don decide sey I nor go do any bad tin, so dat I go always dey obey yor word. 119:102 I neva sin against yor laws, bikos Yu tish mi well. 119:103 Yor word sweet well-well for my mout; dem even sweet pass honey. 119:104 Yor kommandment don make mi undastand life well and na-im make mi hate to do bad tins. 119:105 Yor word na lantan wey dey guide my leg and lite wey dey make mi si road. 119:106 I don first promise and I dey promise again sey; I go always dey obey all yor kommandment. 119:107 My God, I don sofa well-well; so make Yu save my life just as Yu promise. 119:108 My God make Yu asept di ofrin wey my praiz bring and tish mi yor kommandment. 119:109 Even doh my life nor balance at-all, I nor go stop to obey yor kommandment. 119:110 Even doh wiked pipol set dia trap for mi, I nor go turn from yor kommandment. 119:111 Na yor laws bi my special propaty; na dem my heart wont 119:112 and I dey ready to keep wetin Yu tok till I die. 119:113 I hate pipol wey dey pritend sey dem dey loyal to evribody, but I love yor kommandment. 119:114 Na Yu bi my proteshon and guide and na yor word dey give mi hope. 119:115 Una wey bi sey na wiked and evil tins full una mind, make una komot from my life; bikos na my God kommandment I go obey till I die. 119:116 My God, make Yu give mi life as Yu promise, so dat I nor go die! 119:117 Make Yu keep mi and I go dey save; den I go always dey follow wetin Yu tok. 119:118 Yu don rijet all di pipol wey nor dey follow yor ways and naw, dem just dey fool diasef. 119:119 Yu swip wiked pipol komot dis world like dirty; know wonder I dey love to obey yor laws! 119:120 I dey shake bikos I dey fear Yu and yor kommandments and rules dey make mi sopraiz. 119:121 I dey do wetin dey rite, so make Yu nor leave mi for doz wey dey opress mi. 119:122 Abeg, make sure sey Yu bless mi and nor let sturbon pipol opress mi! 119:123 I don taya to look, to si weda Yu go kom save mi; so dat evritin go bi just as Yu promise mi. 119:124 I bi yor savant, so make Yu show mi yor love wey nor dey fail kon tish mi yor laws. 119:125 I bi yor savant, so make Yu give mi sense, so dat I go undastand yor rules. 119:126 E don rish time wey God go take akshon, bikos dis wiked pipol dey break en laws. 119:127 True-true, I love yor kommand pass gold and I even love am pass di gold wey fine pass. 119:128 All yor kommands dey korrect and dat na di rizin why I hate to do bad tins. 119:129 Yor laws dey wonderful. No wonder I dey obey dem! 119:130 Di tishing for yor word dey give lite, so even pipol wey nor go skool dey undastand am. 119:131 I dey hongry for yor kommandment; I dey wait for yor laws. 119:132 Make Yu kom show mi yor mesi, just as Yu dey do to evribody wey love yor name. 119:133 Make yor words guide my step, so dat I nor go waka enter evil. 119:134 Make Yu save mi from wiked pipol wey dey opress mi; den I fit obey yor kommandment well. 119:135 Make Yu look mi with love kon tish mi yor laws. 119:136 I dey kry like river wey dey flow, bikos pipol nor gri obey yor kommands. 119:137 My God, na Yu bi my raitiousness and yor laws good well-well. 119:138 Yor rules dey pafet and wi go fit trust dem. 119:139 E dey pain mi well-well wen my enemies nor gri listin to yor laws. 119:140 I don test yor promise well-well kon si sey dem dey pure and dat na why I always dey love dem. 119:141 Even doh I nor mean anytin at-all to pipol, I nor go fit forget yor kommand. 119:142 Yor judgement na forever and yor laws dey pafet and true. 119:143 Even doh pressure and wahala dey make mi taya, yor kommand still dey make mi happy. 119:144 Yor laws always dey rite; so make Yu help mi undastand dem, so dat I nor go die. 119:145 My God, make Yu ansa mi, bikos I dey pray with all my heart, so dat I go always dey obey yor laws. 119:146 Make Yu save mi, bikos I dey kry to Yu make I for fit obey yor kommand. 119:147 I dey wake-up before day break well and yor words dey give mi hope. 119:148 I nor dey sleep for nite, bikos I dey tink about yor promise. 119:149 So my God, make Yu hear my kry, bikos of yor love wey nor dey fail! Make Yu save mi as Yu dey always do. 119:150 Pipol wey nor dey obey yor law dey kom attack mi; dem nor dey listin to yor kommand at-all at-all. 119:151 But my Oga God, Yu dey near and all yor kommand na true 119:152 and I don know from small pikin sey, yor laws go dey forever and ever. 119:153 Make Yu si di sofa wey I dey sofa kom save mi, bikos I neva forget yor laws. 119:154 Make Yu kom fight and protet my life just as Yu promise. 119:155 Nobody go save wiked pipol, bikos yor laws nor koncern dem at-all. 119:156 My God, si as yor mesi great rish; so make yor laws dey give mi hope as I dey do dem. 119:157 Many pipol dey trobol and wahala mi, yet I neva run or turn from yor laws. 119:158 Wen I si lie-lie pipol, e dey make mi sick, bikos dem nor kare about yor kommandment. 119:159 My God, make Yu si how I love yor kommands. Make Yu give mi back my life, bikos of yor love wey nor dey fail. 119:160 All yor kommand na true and all yor laws go last forever. 119:161 Pipol wey get pawa dey trobol mi wen I nor do dem anytin, but na only yor word dey make my heart shake. 119:162 Like pesin wey si many propaty karry for war, na so too I dey happy to hear yor word. 119:163 Pipol wey dey lie and go against yor word, I hate dem well-well, bikos I love evritin wey Yu tok. 119:164 I go praiz Yu seven times for one day, bikos all yor laws dey rite. 119:165 Pipol wey love wetin Yu tok, get peace of mind and dem nor dey fear, shake or fall. 119:166 My God, I dey wait since make Yu kom save mi and I dey obey yor kommand. 119:167 I dey obey yor laws, bikos I love dem well-well. 119:168 Yes, I dey obey yor kommandment and yor laws, bikos Yu know evritin wey I dey do. 119:169 My God, make Yu listin to my kry; make Yu give mi betta sense thru yor word! 119:170 Make Yu listin to my prayers kon save mi just as Yu promise. 119:171 Make praiz dey always kom out from my mout, bikos Yu don tish mi yor laws. 119:172 Make my tongue sing about yor word, bikos all yor kommandment dey rite. 119:173 Make Yu help mi, bikos I don choose to obey and follow yor kommandment. 119:174 My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi, bikos na yor laws dey give mi hope. 119:175 Make I dey dis life, make yor laws kon help mi, so dat I go always dey praiz Yu. 119:176 I dey waka go like sheep wey waka lost for bush, so make Yu kom find mi, bikos I neva forget yor laws.