Library · pcm

Psalms 124

124:1 Make Israel pipol sey, “If to sey Oga God nor dey awa side?” 124:2 If to sey God nor really dey awa side wen pipol attack us, 124:3 dem for don swallow us alive as dem dey vex. 124:4 River for don kover us; wota for don karry us go. 124:5 Strong wave for river for don kover awa soul. 124:6 So, make wi praiz God wey nor let awa enemies tear us to pieces with dia tit! 124:7 Wi don eskape like bird wey komot from hunta trap. Dia trap and net wey dem set for us, don break and wi don dey free! 124:8 God wey kreate heaven and eart, na-im diliver us from dia hand.