Psalms 13
13:1 My God, Yu go forget mi forever? Na how long Yu go trowey yor face from mi?
13:2 How long I go dey struggol with pain inside my soul and get sorrow for my heart? Na how long my enemies go always dey opress mi?
13:3 My Oga God, make Yu turn kon ansa mi! Make yu give mi strent again or I go die.
13:4 Make Yu nor let my enemies dey make mout sey, “Wi don win am!” Den dem go dey happy sey I don fall.
13:5 But I trust yor love wey nor dey fail. I go happy, bikos Yu don save mi.
13:6 Yes! I go sing to God, bikos E don save mi.