Library · pcm

Psalms 132

132:1 My God, make Yu remember David and all di sofa wey e sofa. 132:2 E make promise give Yu and E vow give di Oga wey bi Israel God sey, 132:3 “I nor go-go my house or go sleep for my bed. 132:4 I nor go gri sleep or let sleep katch mi 132:5 until I find di place where I go build God house put; one big temple for di Oga God wey dey save Israel.” 132:6 Wi hear sey di Kovenant Box dey for Efrat; den wi si am for Jaar town. 132:7 Make wi go God temple; make wi woship am for front of en throne. 132:8 My God, make Yu raiz-up kon enter yor place where rest dey, with di Kovenant Box wey dey show yor pawa. 132:9 Make yor glory kover yor priest; make joy full yor loyal savants heart. 132:10 Bikos I bi yor savant, make Yu nor rijet mi David, di king wey Yu choose. 132:11 God promise David di kind promise wey nor go shange sey: “I go put one among yor shidren for di throne. 132:12 Den if yor shidren-shidren obey di kovenant and di laws wey I tish dem, dem go bi king forever.” 132:13 Yes! God don choose Jerusalem; E don choose di town as en own 132:14 and E sey, “I go dey rest for here forever. I go stay der, bikos na mi choose am. 132:15 I go bless dis town kon make am prosper. Den I go dey feed di poor pipol wey dey di land. 132:16 I go protet en priests and joy go full di heart of doz wey dey fear God. 132:17 For der, I go make David pawa strong; bikos I don decide sey, en shidren-shidren go bi king forever. 132:18 I go disgrace en enemies and David kingdom go rule forever.”