Psalms 136
136:1 Make wi tank God, bikos E dey good and en love wey nor dey fail, dey forever.
136:2 Make wi tank God wey bi di oga of all gods, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:3 Make wi tank di Oga God of all ogas, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:4 Na-im bi di Pesin wey dey do wonderful tins wey dey sopraiz pipol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:5 Di Pesin wey make di heaven with en wisdom, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:6 Di Pesin wey put di eart on-top wota, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:7 Di Pesin wey make di great lite for heaven, bikos en love wey nor dey fail, dey forever:
136:8 Di sun dey rule for day time, bikos en love wey nor dey fail, dey forever,
136:9 and di moon and star dey rule for nite, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:10 Di Pesin wey kill all di first-born for Egypt, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:11 Den E karry Israel pipol komot from der, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:12 E guide dem with en strong hand, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:13 Na-im divide di Red Sea, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:14 Den E take Israel pipol waka pass di river for dry land, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:15 Na-im make Fero and en sojas die inside di Red Sea, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:16 Na God lead en pipol pass di wildaness, bikos en love wey nor dey fail dey forever.
136:17 Di Pesin wey kill strong-strong kings for dem, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:18 E still kill great and mighty kings too, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:19 E kill King Sihon for Amor, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:20 E kill King Og for Bashan, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:21 Den E kon give dia land to en pipol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:22 E give di land to Israel pipol wey bi en savant, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:23 Di Pesin wey dey remember and fight for us wen wi dey trobol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever,
136:24 den kon take us komot from awa enemies hand, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:25 Di Pesin wey dey give food to evritin wey get life, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
136:26 So make wi tank di Oga God wey dey heaven, bikos en love wey nor dey fail, dey forever!