Library · pcm

Psalms 140

140:1 My God, make Yu save mi from wiked pipol! Protet mi from pipol wey like wahala; 140:2 doz wey dey plan evil for dia heart and dey kause trobol waka. 140:3 Dia tongue dey wound pipol like snake and dia lips dey bring out snake poizin. 140:4 My God, nor let mi fall enter wiked pipol hand. Make Yu protet mi from doz wey like wahala, bikos dem dey plan bad against mi. 140:5 Proud pipol don set trap to katch mi; dem spread dia net and dia trap dey evriwhere for di road. 140:6 So I tell Oga sey, “Na Yu bi my God!” So my Oga God, make Yu listin wen I dey kry for help! 140:7 My God wey get pawa, di strong One wey save mi, na Yu protet mi wen my enemies dey fight mi. 140:8 So make Yu nor let wiked pipol win mi, nor let dem susid with dia evil plan, if not, dem go dey proud. 140:9 Make Yu distroy my enemies with di evil and wiked tins wey dem plan for mi. 140:10 Make hot shako fall for dia head. Make Yu trow dem for fire or inside pit wey wota dey, where dem nor go fit komot or eskape. 140:11 Make Yu nor allow pipol wey dey lie, prosper for dis land. Make Yu kause betta wahala for doz wey like trobol. 140:12 But I know sey God go help di pipol wey dem dey opress kon judge well for poor pipol. 140:13 True-true, pipol wey dey do wetin dey rite, dey praiz yor name and doz wey dey fear God, go stay for en present.