Library · pcm

Psalms 150

150:1 Make wi Praiz God! Make wi praiz am for en temple; make wi praiz am for di sky wey dey tok about en great pawa! 150:2 Make wi praiz am for di big-big tins wey E dey do; make wi praiz am, bikos en greatness good pass evritin! 150:3 Make wi praiz am with trumpet sound; make wi praiz am with jita and harp! 150:4 Make wi dance praiz am with sheke-sheke; make wi praiz am with jita and flute! 150:5 Make wi dey nak cymbals togeda as wi dey praiz am. Yes! Make wi praiz am with loud cymbals. 150:6 Make evritin wey dey alive, sing praiz God. Make evribody praiz God!