Psalms 16
16:1 My God, make Yu protet mi, bikos I don run kom meet Yu for help.
16:2 I tell my Oga God, “Na Yu bi my Masta! Evry good and betta tin wey I get, na Yu give dem to mi.”
16:3 Na doz wey dey fear God for dis land, I dey respet pass! I dey happy to si and listin to dem.
16:4 Pipol wey dey run follow oda gods, dia trobol dey plenty evriday. I nor go follow dem do dia blood sakrifice or even koll dia god name.
16:5 My God, na Yu dey make mi strong and prosper; Yu don give mi betta future.
16:6 Evritin dey work for my good! True-true, E don bless mi well-well.
16:7 So I go bless God wey dey guide mi; even for nite, my heart dey happy to praiz am.
16:8 I don make God nomba one for evritin wey I dey do and bikos E dey for my rite side, I nor go shake or fear anytin.
16:9 No wonder happiness full my heart, bikos I dey rest well and fear nor dey my life.
16:10 Bikos God nor go leave my soul inside grave or allow en holy pikin rotin for der.
16:11 Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.