Library · pcm

Psalms 18

18:1 My God, I love Yu well-well and na Yu bi my strent. 18:2 Na God bi di rock wey dey protet mi. Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi and I dey save inside am. 18:3 I koll God wey get all di praiz and E save mi from my enemies. 18:4 Deat dey round mi and trobol won kill mi; 18:5 na so-so grave I dey dream about and na to die, dey hongry mi. 18:6 But inside my trobol, I kry to God. Yes! I pray to my God make E kom help mi and E hear mi from en temple, bikos my kry rish en ear. 18:7 Fear kon make di pipol for di eart dey shake. Di mountins foundashon kon dey shake too; dem dey shake bikos God dey vex. 18:8 Smoke dey kom out from dia nose; fire dey pour kom out from dia mout with hot shako. 18:9 So, God open di heavens kon kom down and dark kloud dey under en leg. 18:10 E sidan on-top angel feada kon fly go; E fly go with strong breeze. 18:11 E kon hide ensef for darkness and na di strong dark kloud E take round ensef. 18:12 Betta tick kloud kover di lite wey dey round am and many stones and shako kon dey fall. 18:13 God vois from heaven bi like tonda and evribody dey hear as di Most High dey shaut. 18:14 E shot en arrow kon skata en enemies and as en lite flash, dem kon dey konfuse more-more. 18:15 Den as God kommand and as E just breath, di sea bottom open and di eart foundashon kon dey show. 18:16 E kom down from heaven kon save mi, den E drag mi kom out from deep wota. 18:17 E save mi from my enemies wey get pawa well-well; from doz wey hate and too strong for mi. 18:18 Dem attack mi wen I dey trobol, but God support and help mi. 18:19 E take mi go where dey save; E save mi, bikos E love mi. 18:20 God reward mi, bikos I do wetin dey rite; E bring mi kom back, bikos I dey innocent and 18:21 bikos I dey always keep en kommand. I neva ever turn from my God kon follow evil. 18:22 I dey follow all en rules and I neva ever rijet en laws. 18:23 For God present, I nor do any bad tin; I don keep mysef from sin. 18:24 God reward mi, bikos I do wetin dey rite. E don si sey I dey innocent. 18:25 E dey show ensef sey E dey faithful to doz wey dey faithful and to doz wey get respet, Yu dey give dem respet. 18:26 To pipol wey get pure heart, Yu dey show dem as Yu pure rish, but to wiked pipol, Yu nor dey sorry for dem at-all. 18:27 Yu save gentol pipol, but dey disgrace proud pipol. 18:28 Yu lite one lamp for mi. Na di Oga my God put lite for my darkness. 18:29 With yor pawa, I fit kill many sojas. With my God wey dey my side, I fit jump pass any wall. 18:30 God ways dey pafet and all en promise na true. E dey guide evribody wey kom make E protet am. 18:31 Na who bi God escept God? Na who again bi Solid Rock escept awa God? 18:32 God make mi strong with en strent and E make my way strait. 18:33 E make my leg strong for groun like deer own kon make mi fit stand on-top high mountins. 18:34 E train my hand, so dat I go fit fight war kon bend even di bow wey strong pass. 18:35 My God, Yu don give mi wetin go protet mi. Yor rite hand dey support mi and I don dey strong, bikos of di way wey Yu dey help mi. 18:36 Yu don make betta road for mi, so dat I nor go draw fall. 18:37 I porshu my enemies kon katch dem and I nor stop until I distroy dem finish. 18:38 I kill all of dem finish and all of dem fall under my leg. 18:39 Yu don give mi strent to fight war; Yu don put my enemies under my leg. 18:40 Yu put my leg for dia neck and I don distroy evribody wey hate mi. 18:41 Wen dem koll pipol to help dem, nobody gri kom. Dem even kry to God, but E nor gri ansa dem. 18:42 I grind dem till dem turn to dust kon swip dem enter gutta like dirty. 18:43 Yu make mi win doz wey dey akuiz mi. Yu make mi rule oda nashons and pipol wey I nor even know, dey serve mi. 18:44 Wons dem hear about mi, dem dey obey. Strenjas and dia kountry pipol dey listin to mi. 18:45 Dem nor get strent again and dem even dey fear for dia house. 18:46 God dey alive! So, make praiz bi my Rock own and I go bless my God wey save mi! 18:47 Na en bi di God wey dey ponish doz wey wound mi. E put di nashons under mi 18:48 kon save mi from my enemies. E keep mi for where my enemies nor go for fit tosh mi kon save mi from wiked pipol. 18:49 Bikos of dis, I go praiz God among di nashons; I go sing praiz to en name. 18:50 Yu don give betta viktory to yor king; Yu don show yor love wey nor dey fail to David wey Yu anoint and to en shidren-shidren forever.