Library · pcm

Psalms 21

21:1 My God, si as di king dey rijoice, bikos of yor pawa! E dey happy and shaut, bikos Yu make am win. 21:2 Yu don gi-am evritin where e wont and na evritin wey e ask for, Yu gi-am. 21:3 Na suksess and progress Yu take welkom am back kon put one fine gold crown for en head. 21:4 Wen e sey make Yu save en life, Yu do evritin wey e ask for and en family go rule forever. 21:5 Yor viktory dey gi-am betta honor. Viktory with majesty wey make evribody know am for evritin. 21:6 Yor blessing bi like klot for en body and Yu gi-am joy for yor present. 21:7 Bikos di king trust God, en love wey nor dey fail, nor go let di king fall. 21:8 Di king go katch all en enemies. E go seize evribody wey hate am with en strong rite hand. 21:9 Wen Yu appear, Yu go trow dem put for fire wey dey burn well-well. God go vex distroy dem for di fire. 21:10 Yu go distroy dia shidren-shidren from dis world and dem nor go ever get shidren again. 21:11 Aldo dem plan against Yu, dia wiked plan nor go work. 21:12 Dem go turn and run from Yu, bikos of yor arrow wey Yu shot. 21:13 My God, make Yu raiz-up with all yor pawa and wi go praiz and sing songs to take celebrate evritin wey Yu don do.