Psalms 30
30:1 My God, I go praiz Yu, bikos Yu save mi and Yu nor let my enemies win mi.
30:2 My Oga God, I dey kry to Yu for help and Yu don make mi well.
30:3 My God, Yu don bring mi kom out from grave. Yu keep mi, so dat I nor go fall inside pit where dead body dey.
30:4 All of una wey dey fear God, make una sing to am!
30:5 Bikos en vexnashon nor dey tey, but en favor dey last forever! Even doh I kry for nite, I know sey joy go kom for morning.
30:6 Dat time wen I don get evritin wey I nid, den I go kon sey, “Nor-tin go fit make mi poor again!”
30:7 But my God, wen yor favor don sikure mi like mountin, Yu kon turn from mi and evritin wey I get kon skata.
30:8 My God, I dey kry and beg Yu for mesi kon sey,
30:9 “Wetin Yu go gain if I die? Wetin Yu go get if I enter grave? Dead body go fit praiz Yu?
30:10 My Oga God, make Yu hear mi kon sorry for mi. Make Yu kom help mi.”
30:11 Naw, Yu don turn my sorrow to happiness. Yu remove di klot wey I take dey mourn kon wear joy for my body like klot,
30:12 so dat I go sing praiz Yu and I nor go kwayet. So, I go tank Yu wey bi my Oga and God forever!