Psalms 38
38:1 My God, make Yu nor porshu or ponish mi, bikos Yu dey vex!
38:2 Yor arrow don shuk mi. E don wound mi well-well
38:3 and bikos Yu dey vex, my body nor dey strong again, bikos of my sin.
38:4 I dey die inside my own sin and dis wahala too heavy for mi to karry.
38:5 Bikos of my sins, di sore for my body don start to smell.
38:6 I nor fit stand strait again and wahala full my life. Evriday, I dey kry and mourn waka.
38:7 I dey shame well-well and na so-so sick I dey sick.
38:8 I don taya and my own don finish. I dey kry from my heart, bikos of all di pain for my body.
38:9 So, Oga God, I know sey Yu know wetin I wont. Yu dey hear as I dey kry with pain.
38:10 My heart dey beat fast-fast; my pawa don finish and my eye don blind.
38:11 Pipol wey I love and wey bi my friends, dey run from mi, bikos dem dey fear my diziz. Even my own family membas stand for far dey look mi.
38:12 Yet, my enemies still dey set trap to kill mi. Pipol wey hate mi dey plan to skata my life and na evriday dem dey plan against mi.
38:13 But I bi like who nor dey hear wetin dem dey tok. I kwayet dey look dem like sey I nor sabi tok.
38:14 Naw, I bi like deaf to dem. I nor dey ready to kworel or ansa dem back.
38:15 But I dey wait for Yu, my God. My Oga God, make Yu kom ansa mi.
38:16 I dey pray, “Make Yu nor let my enemies happy, bikos I fall for groun.”
38:17 Na die I dey so o-o, bikos na so-so pain I dey face.
38:18 But naw, I dey konfess my sins; I really dey sorry for evritin wey I don do.
38:19 I get many wiked enemies and dem hate mi without any rizin.
38:20 Dem dey pay mi bad for good kon dey oppoz mi for di good tins wey I do.
38:21 So my God, make Yu nor leave mi. Nor stand for far dey look mi.
38:22 My God and Savior, make Yu kwik-kwik kom help mi.