Psalms 50
50:1 Di Almighty One wey bi God don tok; E don gada evribody rite from where di sun for dey raiz go rish where e for dey go down.
50:2 From Mount Zion wey fine well-well, God dey shine inside en glory.
50:3 Awa God dey kom and E nor dey kwayet at-all. Fire dey burn evritin wey dey en way and strong breeze wey dey make nois, dey round am.
50:4 E dey koll di heavens wey dey up and di eart wey dey under, so dat dem go bi witness wen E dey judge en pipol.
50:5 E sey, “Make una bring my pipol wey dey obey mi kom, doz wey make kovenant with mi with dia sakrifice.
50:6 Make di heaven tok about how E take dey judge bikos na God go judge by ensef. Make di heavens tok about en good judgement, bikos na God bi di judge.
50:7 My pipol, make una listin as I dey tok. Israel pipol, dis na wetin I get against una, na Mi bi di Oga wey bi una God!
50:8 I nor dey komplain about una sakrifice or di burnt ofrin wey una always dey offa.
50:9 I nor nid di melu from una house again or wont di goat from una farm.
50:10 Bikos na mi get all di animals for forest and all di many goats wey dey di hills.
50:11 I know all di birds for di mountin and all di animals for di field, na my own too.
50:12 If to sey I dey hongry, I nor go tell una, bikos na mi get di world and evritin wey dey inside.
50:13 I dey chop melu meat? Abi I dey drink goat blood?
50:14 So make tanksgivin bi una sakrifice to God, den make una keep di promise wey una make to di Most High.
50:15 Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una, den una go give mi all di glory.”
50:16 But God tell wiked pipol: “Wetin make una dey learn my laws and dey pritend sey una dey obey my kovenant?
50:17 Una nor gri listin to my kommand, instead una dey do my word anyhow like dirty.
50:18 Wen una si tifs, una go hail and klap for dem and una dey spend una time with pesin wey dey sleep with who e nor marry.
50:19 Na so-so wiked tins full una mout and na lie-lie full una tongue.
50:20 Una go just sidan dey tok bad about una broda; di pikin wey una own mama born.
50:21 As una dey do all dis tins, I nor tok at-all and una feel sey I nor kare. But naw, I go distroy una kon rite evritin wey I get against una.
50:22 All of una wey don forget mi, make una turn from sin kom meet mi or I go kill una finish and nobody go kom help una.
50:23 But to dey give tanks, na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body. So if una follow my kommand, I go show una how God salvashon bi.”