Library · pcm

Psalms 63

63:1 Oga, na Yu bi my God and e don tey wen I dey wait for Yu, bikos my soul dey hongry for Yu. My whole body dey hongry for Yu inside dis dry and pash-pash land wey nor get wota. 63:2 I don si Yu for di temple kon si yor mighty pawa and glory. 63:3 Yor love wey nor dey fail betta pass life; so I go praiz Yu! 63:4 I go praiz Yu as long as I dey dis life and I go raiz my hand kon pray give Yu. 63:5 Just as meat dey satisfy pesin na so too Yu satisfy my soul. So my mout go always dey praiz Yu 63:6 and for nite, I nor dey fit sleep, bikos I dey tink about how Yu 63:7 help and save mi. I dey sing for joy, bikos I dey under yor shadow. 63:8 I hold Yu tait, bikos na yor strong rite hand dey save mi. 63:9 But distroshon go follow doz wey dey plan to distroy mi. Dem go die go where dead body dey. 63:10 Na swod go kill dem, den birds and oda animals go chop dia body. 63:11 But di king go happy bikos of God love. Evribody wey trust God go dey boast, bikos pipol wey dey lie, go shut up forever.