Psalms 83
83:1 My God, make Yu nor kwayet just like dat! Make Yu nor rijet us! Nor just do like sey e nor koncern Yu!
83:2 Yu nor si di nois wey yor enemies dey make? Yu nor dey si sey yor sturbon enemies dey make mout anyhow?
83:3 Dem dey plan against yor pipol and dem won wound di ones wey Yu love.
83:4 Dem dey sey, “Make una kom make wi kill evribody for Israel finish and nobody go remember dem again.”
83:5 All of dem gada togeda and dem dey plan against Yu.
83:6 Dem wey gada so na: Edom and Ishmael pipol, Moab and Hagrit pipol;
83:7 Gebal, Ammon and Amalek pipol with doz from Filistia and Tyre.
83:8 Assyria pipol don join dem too with Lot shidren-shidren.
83:9 So, make Yu do dem wetin Yu do Midian pipol and just as Yu do Sisera and Jabin for Kishon River, na so too Yu go do dem.
83:10 Dem die for Endor and dia body kon make di grass grow well.
83:11 Make di mighty ones among dem die like Oreb and Zeeb. Make all di prince die like Zebah and Zalmunna
83:12 wey bin sey, “Make wi take dis land wey bi God own!”
83:13 My God, make Yu skata dem like leaf and san-san wey breeze dey blow!
83:14 As fire dey burn forest and smoke dey make mountin burn,
83:15 na so too Yu go take porshu dem with yor strong tonda kon make dem fear.
83:16 My God, make Yu disgrace dem finish until dem bigin praiz yor name.
83:17 Make shame and fear follow dem forever and make dem die with disgrace.
83:18 Den dem go know sey na only Yu bi God, di Pesin wey get pawa pass for di whole world.