Psalms 97
97:1 God na king! Make di eart happy! Make river and sea happy too.
97:2 Dark kloud dey round am. Na to do rite and judge well, bi di foundashon for en throne.
97:3 Fire dey round God for front and E burn all en enemies for evry side.
97:4 En tonda lite dey shine round di eart, so wen di eart si am, e kon dey shake.
97:5 Di mountins dey melt like butter wen dem si God wey get di whole eart.
97:6 Di heavens dey tok about en raitiousness; evribody dey si en glory.
97:7 But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju; doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin, bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.
97:8 Jerusalem pipol and all di towns for Judah don hear about am and dem dey happy, bikos of how God dey judge pipol!
97:9 Yu, God get pawa pass evritin for dis world; so dem go praiz Yu pass any oda god.
97:10 Una wey love God, make una hate bad tins! God dey protet pipol wey dey fear am kon save dem from wiked pipol pawa.
97:11 Pipol wey dey fear God, lite dey shine for dia body and doz wey get pure heart, dey always happy.
97:12 So make evribody wey dey fear God, happy kon praiz en holy name!