Library · pcm

Exodus 1

1:1 Dis na Jakob shidren wey follow am go Egypt and each one karry en family follow body: 1:2 Reuben, Simeon, Levi, Judah, 1:3 Issakar, Zebulun, Benjamin, 1:4 Dan, Naftali Gad and Asher. 1:5 Jakob family for Egypt, na seventy (Josef don already dey Egypt before dem kom). 1:6 Afta sometaim, Josef, en brodas and doz wey bi dia age mate kon die. 1:7 So Israel pipol kon plenty and dey strong for di land. 1:8 Den one new king wey nor know Josef kon dey rule Egypt. 1:9 So di king kon tell en pipol, “Make una si, Israel pipol dey plenty and dem strong pass us! 1:10 Make wi handle dem with sense, if not, dem go dey plenty more-more and if war happen naw, dem go join awa enemies fight us, den dem go run komot from dis land.” 1:11 So dem kon dey sofa and ponish Israel pipol. Na Israel pipol build Pitom and Rameses as di place wey Fero go dey keep tins put. 1:12 But even as Egypt pipol dey opress Israel pipol, dem still dey plenty more-more for di land and Egypt pipol kon dey fear dem well-well, 1:13 so dem kon dey ponish Israel pipol anyhow. 1:14 Egypt pipol make life taya Israel pipol with di kind hard work wey dem dey do with mortar, stones and all di work for di field. 1:15 Di king wey dey rule Egypt kon tell Shifrah and Puah wey bi di Hibru nurse sey; 1:16 “Anytime wen una dey help di Hibru wimen wey won born, if una si sey di pikin na boy, make una kill-am, but if na girl, make una nor kill-am.” 1:17 But di nurse dem dey fear God and dem nor gri do wetin di king tell dem, so dem nor kill di boys. 1:18 Den di king koll di nurse kon ask, “Why una do dis kind tin? Why una nor kill di boys?” 1:19 Di nurse ansa Fero, “Hibru wimen nor bi like Egypt wimen; dem strong well-well and before wi go even rish der, dem don born!” 1:20 So God favor di nurse dem and Israel pipol kon dey plenty and strong. 1:21 Bikos di nurse dem dey fear God, Oga God kon give dem dia own family. 1:22 So Fero kommand en pipol, “Make una go kill any boy wey dem just born kon trow dem inside River Nile, but make una leave all di girls.”