Library · pcm

Exodus 15

15:1 Den Moses and Israel pipol bigin sing dey praiz God sey, “Wi go sing to God, bikos E don give us viktory. E trow di shariot and doz wey dey ride dem inside di sea. 15:2 Na God bi my pawa and Savior. Dis na my God and I go praiz am. My grand-grand papa dem God and I go sing about how E great rish. 15:3 Awa Oga sabi fight war, na God bi en name. 15:4 E trow Fero shariot, all en sojas and strong ofisas inside di Red Sea kon kill dem. 15:5 Di deep sea kover dem; dem sink go bottom like stone. 15:6 My Oga God, yor rite hand get betta pawa and e skata di enemies to pieces. 15:7 With yor pawa as King, Yu don fall doz wey stand to fight Yu. Yu burn dem like dirty, bikos Yu dey vex. 15:8 Yu breath from yor nose and di wota kon full. Di river wey dey flow kon stand like wall and di part wey deep pass for di sea, kon strong. 15:9 Di enemies sey, ‘I go porshu, katch, divide dia propaty kon take evritin wey I wont. I go distroy dem with my swod.’ 15:10 But Yu breath from yor nose and di sea swallow dem. Dem sink like stone inside di big sea. 15:11 My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins? 15:12 Yu stresh yor rite hand and di groun swallow dem. 15:13 With yor true love, Yu go lead di pipol wey Yu save and with yor pawa, Yu go show dem di way to yor holy land. 15:14 Oda kountries go hear wetin happen kon fear Yu; betta fear go hold Filistia pipol. 15:15 Den Edom leaders go fear well-well; di strong men for Moab go dey shake and di pawa wey Kanaan pipol get, go vanish. 15:16 Betta fear go katch dem and with yor great pawa, dem go bi like stone kon dey fear until di pipol wey Yu save, go waka pass. 15:17 Yu go take dem enter inside di land kon plant dem for yor mountin; di place where Yu choose as yor house, bikos na Yu wey bi my Oga God, build am as yor own Temple. 15:18 God go reign forever and ever! 15:19 “Wen Fero men with dia shariot enter di sea, Oga God kon make wota swallow dem, but Israel pipol waka pass for dry groun.” 15:20 Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance. 15:21 Miriam sey, “Make wi sing to di Oga awa God, bikos E don win big war; E trow di horse and doz wey dey ride am inside di sea.” 15:22 Den Moses lead Israel pipol from di Red Sea enter Shur wildaness. Dem travel inside di wildaness for three days and dem nor si wota drink. 15:23 Den dem rish Marah, but dem nor fit drink di wota wey dey dat place, bikos e bitter (na dis make dem dey koll am, Marah.) 15:24 So di pipol bigin komplain give Moses sey, “Wetin wi go drink?” 15:25 Moses kry to God and God kon show am one stik. Wen e trow am inside di wota, di wota kon dey good to drink. So for der, God give dem laws kon try dia faith. 15:26 God sey, “If una really obey di Oga una God kon do wetin good for my eyes and listin to my kommand, I nor go sofa una with all di diziz wey I send go Egypt, bikos na mi bi di Oga una God wey dey heal una.” 15:27 Den dem go Elim where dem si twelf well and seventy palm tree. So dem kon stay near di wota.