Exodus 18
18:1 Jetro, Moses wife papa, wey bi priest for Midian kon hear all di tins wey God don do for Moses and Israel pipol. How God take free dem from Egypt.
18:2 So Jetro kon bring Zipporah, Moses wife wey Moses bin live for Midian
18:3 and en two sons, Gershom (bikos Moses sey, “I bi strenja for anoda land”);
18:4 and Elieza (wey mean, “Na awa papa God help and save mi from Fero”).
18:5 Jetro karry Moses wife and en two sons go meet Moses for inside di wildaness, where dem dey for God mountin.
18:6 But e first send message to Moses sey, “I dey kom with yor wife and yor two pikin.”
18:7 So Moses go meet en wife papa, bow kon kiss am. Dem greet each oda kon enter house.
18:8 Moses tell en wife papa evritin wey God do to Fero and Egypt pipol, bikos of Israel pipol; di tins wey dem sofa for road and how God take save dem.
18:9 Den Jetro kon dey happy for all di good tins wey Oga God do for Israel pipol wey E save from Egypt.
18:10 Jetro kon sey, “Make una bless Oga God wey save una from Fero and Egypt pipol. Di God wey save en pipol from sofa.
18:11 Naw, I know sey God big pass all di gods, bikos en pipol don dey save from Egypt pipol pawa; Egypt pipol wey wiked and like yanga well-well.”
18:12 Den Jetro sakrifice and burn ofrin for God. So Aaron and all di eldas for Israel join Moses wife papa chop di food for God present.
18:13 Di next day, Moses sidan to judge kase and pipol gada round am from morning till evening.
18:14 Wen en wife papa si all di tins wey Moses dey do for di pipol, e kon ask am, “Why yu dey do all dis tins for dis pipol? Na only yu sidan dey judge from morning go rish evening?”
18:15 Moses ansa am, “Dis pipol dey kom meet mi, so dat dem go know wetin God tok.
18:16 Wen dem get any matter, di pipol go kom and I go judge and let dem know God kommand, en rules and law.”
18:17 Den Moses wife papa tell am, “Di tins wey yu dey do so good o-o.
18:18 But yu go taya one day; both yu and di pipol wey dey with yu, bikos dis tin too heavy for yu and only yu nor go fit karry di load.
18:19 So, I go advise yu and make God dey with yu. Na yu go stand before God for dis pipol kon take dia matter go meet am.
18:20 Make yu tish dem God kommand and law. And make dem know how to live and work as God wont am.
18:21 But make yu choose good men from di pipol. Men wey dey fear God; dey tok true; doz wey nor dey play wayo kon make dem rulers ova di pipol. Some fit rule tazons, odas hundred, some fifty, while some go rule ten.
18:22 Dem go judge di pipol and any matter wey big pass dem, dem go bring am kom meet yu, but na dem go dey judge all di small-small matter. Like dis, dem go follow yu share for di load.
18:23 If yu do dis tin and if na God really kommand yu, den di work go eazy for yu and di pipol go happy go house.”
18:24 So Moses listin to en wife papa kon do all di tins wey e tell am.
18:25 Moses choose men wey fit do di work among Israel pipol kon make dem oga ova di pipol. Some dey rule tazons, odas hundred, some fifty and some ten.
18:26 Dem always dey judge di pipol and any matter wey dem nor fit handle, dem go take am go meet Moses. But na only dem dey judge all di small-small matter.
18:27 Den Moses escort Jetro, en wife papa as e dey go back to en house for Midian.