Exodus 25
25:1 God kon tell Moses:
25:2 “Make yu tell Israel pipol make dem bring ofrin kon give mi. Yu go kollect di ofrin wey pipol go give from dia heart.
25:3 Na dis kind ofrin yu go kollect from dem: gold, silva, bronze,
25:4 fine linen, blue, purpol and red wool; klot wey dem make with goat hair,
25:5 ram skin wey dem dye with red, fine leda, akasia wood,
25:6 oil for di lite, spices for di anointin oil and for di incense wey get betta smell.
25:7 Onyx stones and oda tins wey dem go put for di priest garment and for di chest side.
25:8 Make dem build house for mi, so dat I go fit follow una stay.
25:9 Yu must make am with all di tins wey dem go put inside, just as I show yu.”
25:10 “Make dem build box with akasia wood wey long rish three fit nine inches and e go wide and high rish three fit.
25:11 Make dem kover inside and outside di box with pure gold.
25:12 Yu go make four gold ring kon put am for di four leg; two-two ring for each side.
25:13 Make some pole with akasia wood, kover am with gold
25:14 kon take di poles pass inside di rings wey dey di box side, so dat dem go fit use dem karry di box.
25:15 Di poles must dey inside di rings for di box; dem must nor take dem komot.
25:16 Di two small flat stones wey I go rite my kommandment put, yu go put dem inside di box.
25:17 “Make yu make one kover with pure gold; e go long rish three fit nine inches kon wide rish two fit three inches.
25:18 Yu go use gold wey dem melt take make two tins wey bi like angel wey get plenty feada kon put dem for di two korna for di box kover.
25:19 One among di angels wey dem make, go dey one end and di sekond one go dey di oda end.
25:20 Di angels go spread dia feada kon kover di box and di angels go face each oda dey look di box.
25:21 Yu go put di box kover on-top di box, den kon put di flat stones wey I go give yu, inside.
25:22 Den I go meet yu for der and from di box kover; between di two angels wey kover di box wey di kommandment dey, I go tell yu all di tins wey yu go kommand Israel pipol.
25:23 “Yu go use akasia wood take make one tabol; e go long rish three fit; wide like one fit six inches and e go high rish two fit three inches.
25:24 Yu go design am with pure gold.
25:25 Yu go make rim wey wide and round rish three inches kon do borda round di rim.
25:26 Yu go use gold make four rings kon put dem for di four korna wey di legs dey.
25:27 Di rings go dey near di rim and e go bi di poles wey dem go take dey karry di tabol.
25:28 Yu go use akasia wood take make all di poles kon design dem with gold, so dat dem go fit karry di tabol with dem.
25:29 Yu go make some plate, cup, jar and bowl wey dem go dey use for di wine ofrin. All dis tins, na pure gold yu go take make dem.
25:30 Yu must always keep di Holy Bread wey yu go give mi on-top di tabol.
25:31 “Yu go make one lampstand with gold. Na gold wey dem melt yu go take make di bottom, en leg, cups, di small-small seeds and di flowers go bi di same with am.
25:32 Di lampstand go get six side: from en leg, three go dey one side and anoda three go dey di oda side.
25:33 Three cup wey dem shape like almond flower wey get small-small seeds, go dey di next branches and na di same tin e go bi for di six branches wey go kom out from di lampstand.
25:34 And for di lampstand, e get four cup wey dia shape resemble almond flower wey get small-small seeds and shine-shine.
25:35 One of di small-small seed go dey under all di six branches wey kom out from di lampstand.
25:36 Na di same pure gold wey yu melt, yu go take make dia small-small seed, branches and lampstand.
25:37 Yu go make seven lamp for di lampstand kon stand am, so dat e go give lite to di aria for en front.
25:38 Yu go use pure gold take make di lampstand korna and di tray.
25:39 Make yu use about seventy-five pound for pure gold take make di lampstand and di oda tins.
25:40 “Naw, make sure sey yu make dem, just as I show yu for di mountin.