Library · pcm

Exodus 31

31:1 God tell Moses, 31:2 “Si, I don koll Bezalel wey bi Uri pikin wey en grand-papa kom from Hur tribe for Judah. 31:3 I don put my Spirit inside am, so dat e go know how to do difren work. 31:4 E know how to design some fine tins with gold, silva and bronze and 31:5 how to kut wood and set stones. E still know how to do kraft work well-well. 31:6 I don sey make Oholiab wey bi Ahisamak pikin from Dan tribe, work with am. I don give special skill to all dis pipol wey sabi work, so dat dem fit make all di tins wey I kommand yu to do: 31:7 di Tabanako; di Testimony Box; di atonement box kover wey dey on-top; all di tins wey dey inside di Tabanako; 31:8 di tabol and di tins wey dey on-top; di pure lampstand with all di tins wey hold am, di incense altar, 31:9 di burnt ofrin altar with all di tins wey e dey use; di basin with en stand; 31:10 di garment wey dem weave; di holy garment wey Aaron and en sons go wear to take serve as priest; 31:11 di anointin oil and di sweet incense for di holy place. Di men must make evritin, just as I kommand yu.” 31:12 God kon tell Moses, 31:13 “Go tell Israel pipol sey, ‘Una must keep my Sabat Day, di day wey I dey rest, bikos na sign between mi and una thru-out una generashon and e dey show sey na mi bi di God wey choose una. 31:14 Una must keep di Sabat Day, bikos e dey holy to una. Anybody wey work for dat days, must die. 31:15 Una get six days to work, but di sevent day wey bi Sabat Day, na to rest, bikos e dey holy to God; anybody wey work for di sevent day, must die. 31:16 Israel pipol must keep di Sabat Day and obey am from one generashon go rish anoda. Dis kovenant go last forever. 31:17 Na sign between mi and Israel pipol forever. Bikos God use six days take kreate di heaven and di eart and E rest for di sevent day.’ ” 31:18 Wen God don tok to Moses finish for Mount Sinai, E kon gi-am two stones wey E rite di kommandment put.