Exodus 37
37:1 Bezalel make di box with akasia wood; e long rish three fit nine inches kon wide rish two fit three inches and e high rish two fit three inches.
37:2 E wrap am with pure gold, both for inside and outside. Den e take gold make borda round am.
37:3 E make four gold rings kon tie dem for di four korna with two ring for one side and anoda two ring for di sekond side.
37:4 Den e use akasia wood take make poles kon wrap dem with gold.
37:5 E put di poles inside all di ring for di box korna, so dat dem go fit karry di box.
37:6 E still make di kover with pure gold and e long rish three fit nine inches kon wide rish two fit three inches.
37:7 E melt gold take make two angel kon put dem for di two end for di kover.
37:8 One angel for one end and di oda angel for di oda end. E make dem, so dat dem go bi di same with di kover.
37:9 And di angels spread dia feada, so dat e go kover di box. Dem dey protet di box as dem face each oda.
37:10 Bezalel use akasia wood take make di tabol; e long rish three fit; wide like one fit six inches and e high rish two fit three inches.
37:11 E kover am with pure gold kon use gold do borda round am.
37:12 E still make frame for am wey wide rish three inches kon take am round am and e make gold borda for di frame.
37:13 Den e make four gold rings kon tie di rings for di four korna where di four legs dey.
37:14 Di rings dey near di frame to kreate shance for di poles wey karry di tabol.
37:15 Bezalel make dis poles with akasia wood kon dekorate dem with gold.
37:16 Den e use pure gold make special kontaina for di tabol tins like: plates, cups, jars and bowl wey dem go use take pour di wine ofrin.
37:17 Bezalel melt pure gold take make di lampstand. E make all di lampstand with en dekorashon with one material; di bottom, en shaft, en cups, di fine flower, en small-small seed and di petal.
37:18 Di lampstand get six branches wey kom out from all en side; tree branches from each side.
37:19 Each of di six branches get three cup wey dem design like flower wey get small-small seeds and dem dey shine.
37:20 Four cups wey get shape like almond flower wey get small-small seed, dey for di lampstand.
37:21 E get small-small seed under di first two branches wey kom out from am and na so e bi for di six branches with two branches afta each oda.
37:22 Dia small-small seed and branches na from di same material; all of dem na pure gold wey dem melt.
37:23 E still make seven lamp for di lampstand, with trimma and tray wey bi pure gold.
37:24 E make di lampstand and all di tins wey follow am with seventy-five pounds of pure gold.
37:25 Bezalel use akasia wood take make di incense altar. E long like one foot and half and na so e wide rish too, e kon bi skware. E high rish three fit. Na one material e still use make en horns.
37:26 E design am with pure gold both for di top, en four wall and en horns, den e use gold take make borda round am.
37:27 E still make two gold rings for am under en borda for di two side, so dat e go hold di poles wey dem go take karry dem.
37:28 E take akasia wood make di poles kon design dem with gold.
37:29 E make di holy anointin oil and di incense wey get good smell, just like pesin wey sabi make perfume, dey do.