Library · pcm

Exodus 6

6:1 Den Oga God tell Moses, “Naw, yu go si wetin I go do Fero. I go force am make e allow my pipol go. I go use my pawa take make am drive my pipol komot from dis land.” 6:2 So God tell Moses, “Na mi bi Oga God. 6:3 ‘Na mi appear to Abraham, Isaak and Jakob as di Almighty God, but di pipol nor know sey my name na Oga God,’ too. 6:4 I still make kovenant with dem kon promise sey, ‘I go give dem Kanaan pipol land, where dem stay as strenja.’ 6:5 Naw, I don hear Israel pipol kry, bikos of how Egypt pipol dey sofa dem and I don remember my kovenant. 6:6 “So tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi Oga God and I go remove di load wey Egypt pipol put for dia head and dem nor go bi slave again. Na my pawa I go take save una and I go ponish Egypt pipol. 6:7 I go take una as my pipol and I go bi una God. Den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God. Di One wey save una from Egypt pipol hand wen dem dey sofa una. 6:8 I go take and give una di land wey I promise sey I go give Abraham, Isaak and Jakob. Na mi bi Oga God!’ ” 6:9 Moses tell Israel pipol dis tins, but dem nor listin to am, bikos of dia sofa. 6:10 Den God tell Moses, 6:11 “Make yu go tell Fero wey bi Egypt king sey e must free Israel pipol from en land.” 6:12 But Moses ansa, “If Israel pipol nor gri listin to mi, den how Fero go kon take listin to mi, since I nor dey fit tok well?” 6:13 God kon kommand Moses and Aaron about Israel pipol and E sey make dem tell Fero wey bi king for Egypt sey make e free Israel pipol from en land. 6:14 Dis na di head for di difren family for Israel: Reuben wey bi Israel first pikin, born Hanok, Pallu, Hezron and Karmi. Na dis pipol bi Reuben family. 6:15 Simeon shidren na Jemuel, Jamin, Ohad, Jakin, Zohar and Shaul wey en mama kom from Kanaan. Na dis pipol bi Simeon family. 6:16 Levi shidren akordin to dia rekord na Gershon, Kohat and Merari. (Levi stay for one hundred and thirty-seven years.) 6:17 Gershon shidren akordin to dia family, na Libni and Shimei. 6:18 Kohat shidren na Amram, Izhar, Hebron and Uzziel. (Kohat stay for one hundred and thirty-three years.) 6:19 Merari shidren na Mahli and Mushi. Na dis pipol kon bi Levi family akordin to dia rekord. 6:20 Amram marry en papa sista, Jokebed and e born Aaron and Moses. (Amram stay for one hundred and thirty-seven years, before e die). 6:21 Di shidren wey Izhar born na Korah, Nefeg and Zikri. 6:22 Uzziel shidren na Mishael, Elzafan and Sitri. 6:23 Aaron marry Elisheba wey bi Amminadab dota and Nahshon sista. Di woman born Nadab, Abihu, Eleazar and Itama for Aaron. 6:24 Korah pikin na Assir, Elkanah and Abiasaf. Na dis pipol bi Korah family. 6:25 Naw, Eleazar wey bi Aaron pikin marry one among Putiel dota and e born Finehas for Eleazar. Na all dis pipol kon bi Levi tribe. 6:26 Na dis Aaron and Moses, God still tell sey, “Make una take Israel pipol komot from Egypt.” 6:27 Na dem bi di men wey tok to Fero, so dat dem go fit take Israel pipol komot from Egypt. 6:28 Wen God tok to Moses for Egypt, 6:29 E tell am, “Na mi bi di Oga, yor God. All di tins wey I dey tell yu since, make yu go tell Fero wey dey rule Egypt.” 6:30 But Moses ansa, “Since I nor fit tok well, how Fero go take listin to mi?”