Proverbs 24
24:1 Make yu nor jealous evil pipol or try to make friend with dem,
24:2 bikos na only trobol dem dey always tink about and anytin wey dem tok, dey kause wahala.
24:3 Na wisdom pesin dey take build house, but na undastandin go make am stand
24:4 and na knowledge dem take dey dekorate am with fine and betta tins.
24:5 To dey wise, betta pass to dey strong! Yes, wisdom betta pass pawa.
24:6 So make sure sey yu plan well before yu go fight and di more dem advise yu well, di more yu go dey win.
24:7 Wise word too deep for foolish pipol to undastand. So wen ever pipol dey tok about sirious matter, foolish pipol nor get any betta tin to tok put.
24:8 If yu dey always plan evil, na trobol-maker dem go dey koll yu,
24:9 bikos anytin wey foolish pesin plan, dey make pesin sin and pipol nor like pesin wey dey laf odas.
24:10 If yu faint for di day wen wahala kom, dat one go show sey yor strent small well-well.
24:11 Kwik save doz wey dem won kill for wetin dem nor do.
24:12 If yu fit sey e nor koncern yu, God know and dey judge evritin wey yu dey do. E dey look yu and E know yu well-well. E go reward yu akordin to wetin yu do.
24:13 My pikin, make yu chop honey bikos e good. Just as honey sweet for yor mout,
24:14 na so wisdom dey good for di soul. Make yu get wisdom and yor future go dey sikure.
24:15 Make yu nor bi like wiked pipol wey dey plan to tif from good pipol or break enter dia house,
24:16 bikos no matter how many times good pipol fall; dem dey always get up again; but trobol dey distroy wiked pipol.
24:17 Make yu nor dey happy if yor enemies enter trobol and nor rijoice wen dem fall,
24:18 bikos God go know if yu dey happy and E nor go like am; den E fit nor kon ponish dem again.
24:19 Make yu nor fear doz wey dey do evil and make yu nor jealous wiked pipol at-all,
24:20 bikos wiked pesin nor get betta future and dem nor dey hope for anytin again.
24:21 So my pikin, make yu fear God and honor di king. Make yu nor do anytin with pipol wey dey tok against dem,
24:22 bikos God fit distroy dat kind pipol wons and who know di wahala wey God and di king fit kause for dem?
24:23 Wise pipol still tok dis tins too: E bad well-well if judge nor dey judge well for kourt.
24:24 If di judge sey na di pesin wey do wrong dey innocent, evribody go curse and hate am.
24:25 Judge wey dey ponish pesin wey do wrong, go prosper and get good name,
24:26 bikos, honest ansa na good sign for true friendship.
24:27 Before yu build yor house, make sure sey yu don prepare and ready yor farm for work.
24:28 Nor tok against anoda pesin without good rizin or tok yeye tins about pipol.
24:29 Nor boast sey, “I go do am back wetin e do mi. Yes! I go deal with am well-well.”
24:30 Wen I waka pass foolish and lazy pesin farm and vineyard,
24:31 na shuku-shuku and grass grow full am. Di wall wey dem build round am, don fall rish groun.
24:32 I look kon tink and I kon learn lesin from am sey:
24:33 Make yu sleep and rest as yu like or fold yor hand and rest small,
24:34 but make yu remember sey, as yu dey sleep, poverty go kom attack yu like tif.