Library · pcm

Proverbs 26

26:1 Just as pipol nor dey espect rain for dry sizin, na so too, respet nor good for foolish pesin. 26:2 Just as bird dey fly pass, na so too, curse wey dem put for yor head and yu nor deserve am, nor go do yu anytin. 26:3 E dey eazy to whip horse and kontrol donkey, but e nor eazy to kontrol foolish pesin. 26:4 If yu ansa yeye kweshon wey foolish pesin ask, den yu dey foolish, just like di pesin wey ask yu. 26:5 Make yu ansa fool akordin to en kweshon, so dat e go know sey e nor wise as e tink, but if yu nor ansa am, yusef go bi fool like am. 26:6 Just as if pesin kut en own leg komot, na so e bi too to send fool message, bikos na trobol di pesin dey look for. 26:7 As pesin wey en leg cripple nor fit use am, na so too foolish pipol words dey yuzles. 26:8 To praiz foolish pesin bi like to put stone for katapault kon ready to shot am. 26:9 Like shuku-shuku wey shuk drunkard man hand, na so too wise word bi for foolish pesin mout. 26:10 Like pesin wey dey shot en arrow anyhow, na so too e bi to pesin wey hire fool take work. 26:11 Just as dog dey go back go chop en vomit, na so fool dey always show en foolishness. 26:12 Pesin wey foolish well-well, betta pass pesin wey tink sey e wise, but e nor get sense. 26:13 Lazy pesin go sey, “Lion dey for outside! Many lion dey evriwhere for di street!” 26:14 Lazy pesin go just dey turn up-and-down for bed like door handle and 26:15 some pipol too lazy to even put food for dia own mout. 26:16 Lazy pesin go tink sey en wise pass seven pipol wey get sense well-well. 26:17 Pesin wey go argue matter wey nor koncern am, bi like wen yu dey waka for road kon go hold dog for en ear. 26:18 Just as e bad for mad pesin to play with bow and arrow, 26:19 na so too e bi with pesin wey deceive en neighbour and e sey, “Nor bi joke I dey joke?” 26:20 Fire nor dey katch without wood; so without aproko, kworel nor go dey. 26:21 Pipol wey like wahala dey kause trobol, just as mashes and kerosine dey start fire. 26:22 Aproko story dey sweet some pipol well-well, but to odas, e dey pain well-well go rish dia bones. 26:23 Pesin wey get wiked heart and dey lie well-well, bi like fine klot wey dem take kover klay pot, so dat pipol go tink sey na betta tin dey der. 26:24 Pesin wey hate odas and dey pritend sey e like dem, na wikedness full en heart. 26:25 Even doh e tok sweet words, make yu nor bilive am, bikos na wikedness full en belle. 26:26 E fit hide en wikedness, but evribody go soon si di bad tins wey e dey do. 26:27 So, anybody wey dig pit for pesin go fall inside my ensef and pesin wey roll stone to wound odas, na di stone go fall kill-am. 26:28 Na only pesin wey yu hate, yu go like lie against and yeye words dey distroy pipol.