Library · pcm

Proverbs 31

31:1 Na di words wey King Lemuel mama tish am, bi dis. 31:2 My pikin wey I born; my son wey I dedikate give God, 31:3 make yu nor waste yor strent dey follow wimen; bikos dem dey distroy kings. 31:4 Lemuel, my pikin! E nor good make king dey drink wine and make rulers too, nor dey take strong drink. 31:5 Bikos wen dem drink, dem fit forget di laws kon dey opress poor pipol. 31:6 Strong drink na for pipol wey dey won die and wine na for doz wey dia heart heavy. 31:7 So allow dem drink forget dia poverty and dem nor go remember dia trobol again. 31:8 Make yu tok for doz wey nor fit tok for demsef; make yu judge well for doz wey dem dey opress. 31:9 Yes! Tok well for doz wey dem dey opress and for poor pipol, den make sure sey dem give dem korrect judgement. 31:10 Who go fit find wife wey get good karata? Good wife betta pass gold. 31:11 En husband go trust am, bikos di wife go support am for evritin wey e dey do. 31:12 Na only good tins e go bring for en husband evritime and bad tins nor dey join. 31:13 E dey always dey do business; e dey make wool and linen klot. 31:14 E bi like ship for river, wey dey karry food kom from far place. 31:15 E dey kwik wake-up for morning to make food for en family kon tell en savants wetin dem go do. 31:16 E go-go look land kon buy am and e go use di money wey e get, take plant tins for der. 31:17 E get pawa, dey strong and dey work hard. 31:18 E know di value for evritin wey e dey make and e dey work go rish nite. 31:19 Na only en dey use tread and nidol take sew en own klot. 31:20 E dey always give tins to poor pipol and to doz wey know get at-all. 31:21 E nor dey worry if kold dey, bikos en family get klot wey go make dem warm. 31:22 Na en dey make en own bed shit and e dey wear fine klot wey dem make with purpol linen. 31:23 Pipol know en husband well-well and dem dey respet am, bikos e dey sidan with di oda eldas, dey take decision. 31:24 E dey make klot and belt kon sell dem give tradas. 31:25 E dey strong; dem dey respet am and e nor dey fear wetin go happen for future. 31:26 E dey tok with betta sense and wisdom full en mout. 31:27 E always dey busy and e dey make sure sey evritin go well for en family. 31:28 En shidren value am and dem dey tank en and en husband. Dem dey always praiz am. 31:29 En husband go sey, “Many wimen na good wifes to dia husband, but yu betta pass all of dem.” 31:30 Gold dey deceive pipol and beauti dey disappear, but make pipol praiz woman wey dey honor and fear God. 31:31 Make una reward am for evritin wey e dey do and evribody must praiz am for di town.