Ecclesiastes 1
1:1 Na King David pikin, Solomon, wey dey rule Jerusalem, rite dis words.
1:2 Di tisha sey, “Evritin dey yuzles! Yes, evritin really dey yuzles!”
1:3 Wetin pipol dey gain from all di hard work wey dem dey do for dis world?
1:4 Wen one generashon kom, di one wey dey before go-go, but di world nor dey shange.
1:5 Di sun dey raiz-up and down, den e go hurry go anoda place where e go for raiz again.
1:6 Breeze dey blow go sout and nort. Yes! E dey blow round like circol.
1:7 Even as wota dey flow enter sea rish, di sea nor dey ever full, bikos, na from where di wota from kom, na der dem go rush go again.
1:8 All dis tins dey taya pesin and nobody fit shange or tok as dem bi: No matter wetin wi dey si and hear, awa eyes still won si and awa ear still won hear more.
1:9 Wetin don happen before, go happen again and wetin pipol don do before, dem go do am again, bikos nor-tin dey new for dis world.
1:10 E get anytin for dis world wey fit make pesin sey, “Kom si o-o! Dis one neva happen before o-o”? But di trut bi sey, e don happen even before dem born us.
1:11 Wi nor dey remember wetin don happen before and for di next generashon, nobody go remember wetin wi dey do naw.
1:12 Mi wey dey tish una, I bi king for Israel and I stay for Jerusalem
1:13 and I make up my mind to search and undastand evritin wey pipol don do for dis world. But I kon si sey, God don really give us betta work to do for dis world.
1:14 As I tink about evritin wey human being dey do for dis world, I kon sey: Evritin dey yuzles; e just bi like sey pesin dey porshu breeze.
1:15 Wetin bend, wi nor go fit strait am and wetin nor dey, wi nor go fit provide am.
1:16 Den I tell mysef, “Na mi wise pass evry oda king wey don rule for Jerusalem before mi. Bikos I get wisdom and undastandin wey dem nor get.”
1:17 So I kon gri to find out wetin wisdom, madness and foolishness bi. But e klear sey, na breeze I just dey porshu,
1:18 bikos di more I dey find out, di more e dey worry mi well-well, bikos plenty wisdom dey bring plenty wahala too. So di more yu know, di more yu dey kause wahala for yorsef.