Ecclesiastes 4
4:1 Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world. I si pipol wey dem dey opress, dey kry and nobody dey to help dem. Nobody dey to save dem from doz pawaful men wey dey opress dem.
4:2 So I sey, e betta well-well for pipol wey don die, pass doz wey still dey alive.
4:3 But di ones wey dia own betta pass, na shidren wey dem neva born, bikos dem neva si all di wiked tins wey dey happen for dis world.
4:4 Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.
4:5 Foolish pesin dey fold en hand and nor dey work, so e nor get anytin to chop, escept en own flesh.
4:6 E betta make yu get small propaty with peace for mind, dan to dey work hard, bikos yu nor go still gain anytin and e bi like wen pesin dey try to katch breeze.
4:7 I still notis anoda tin for life wey dey yuzles.
4:8 E get one man wey dey stay alone, e nor get pikin or broda, but e dey work hard to get more propaty. But e ask ensef, “Na who I dey work for sef wey make mi nor dey fit enjoy mysef?” All dis tins dey yuzles well-well o-o!
4:9 Two pipol betta pass one pesin, bikos dem get betta reward for dia work.
4:10 Bikos if one pesin fall, di oda pesin go help am stand. But pesin wey dey alone, e go bad well-well for am wen e fall.
4:11 Na so too, wen two pipol sleep togeda, dem go fit make each oda body warm, but na how one pesin fit take make ensef warm?
4:12 Dem fit attack and win one pesin wey stand alone, but two pipol go stand fight kon win. Na three pesin even betta pass, bikos e dey hard to kut three rope wey dem tie togeda.
4:13 E betta make yu dey poor and wise as youth, dan to bi old foolish king wey nor dey take advise.
4:14 Even if dem born dat youth for poor house or if e dey prison since, e fit kom out kon bi king for en town.
4:15 I don si for dis world as evribody dey follow one yong man wey dey lead dem afta di king die.
4:16 Even doh many pipol dey support am naw, anoda generashon go grow kon rijet am leta. So yu si, evritin dey yuzles and e just bi like wen pesin dey porshu breeze.