Library · pcm

Song of Songs 2

2:1 Na mi bi di Rose flower from Sharon, di lily flower for di valley. 2:2 Just as lily flower dey among shuku-shuku, na so my darlin bi among oda yong wimen. 2:3 Just as apple tree dey among oda trees for forest, na so my love bi among di yong men. I dey like sidan for where e dey and en fruit dey sweet mi to chop. 2:4 E take mi go di party kon show mi as e love mi rish. 2:5 E give mi kake, so dat I go get pawa kon add apples join am, bikos en love won make mi faint. 2:6 E dey rub my head with en left hand kon dey massage mi with en rite hand. 2:7 Jerusalem wimen! Make una promise mi with animals, like deer and gazelle sey, una nor go disturb awa love. 2:8 Make una listin! My love dey kom. Si! E dey pass di mountins and di hills dey kom meet mi. 2:9 My love bi like gazelle or yong deer. Look! E stand for back of awa wall, where e for dey look di room thru di window. 2:10 My love tell mi sey, “Get up, my darlin! My fine wife, make yu kom follow mi go! 2:11 Si! Kold sizin don pass and rain nor dey fall again. 2:12 Di flowers don dey grow and di time wen birds dey sing, don kom and naw, wi dey hear dove dey sing for awa land. 2:13 Fig tree don dey bring fig fruit kom out and di breeze dey scent with fresh vines. So get up, make yu follow mi, my darlin and sweet wife; kom follow mi make wi dey go!” 2:14 Yu bi like dove wey hide inside rock, so make yu allow mi si yor fine face kon hear yor sweet vois. 2:15 Make una katch all di fox for us; especially di small-small ones, before dem go distroy awa vineyard. 2:16 My love na my own and I bi en own too; e dey feed en animals for where lilys dey. 2:17 My love, before di morning breeze go blow and darkness go disappear, make yu kom back kom meet mi like gazelle or yong deer wey dey on-top mountin.