Song of Songs 5
5:1 I don enter my gardin, my treasure and wife to bi! I don gada myrrh with spices and I don chop my honi-komb and my honey; I don drink my wine and my milk! Una wey sabi love, make una chop and drink until love shark una.
5:2 I dey sleep, my heart dey dream; bikos I hear my love dey nok and sey: “Open for mi, my treasure and darlin; my dove and di rite pesin for mi, bikos dew don wet my head and dust don make my hair dirty.”
5:3 But I ansa, “I don already pul my klot, make I wear am back again? I don wosh my leg, make I dirty am again?”
5:4 My love try to open di door from outside thru di hole and I kon dey feel for am.
5:5 So, I stand won go open di door for my love, but perfume and myrrh full my hand as I dey try to open am.
5:6 I open di door for my love, but e don go! I vex well-well. I look evriwhere, but I nor si am. I koll am, but nobody ansa mi.
5:7 Di guide dem for nite si mi as dem dey waka dey guide di town wall. Dem beat, wound and remove di klot wey I take kover my face.
5:8 So Jerusalem wimen, make una promise mi sey: If una si my love, una go help mi tell am sey, en love don make mi dey sick.
5:9 Woman wey fine well-well, wetin make yu tink sey yor love betta pass oda men? Wetin dey good about yor love, wey go make us promise yu?
5:10 My love fine well-well and e dey strong; e betta pass 10,000 pipol!
5:11 En hair bi like fine gold and e dey shine like black bird.
5:12 En eye dey shine like dove wey dey near spring wota; dem bi like betta gold wey dem wosh with milk.
5:13 En jaw bi like gardin wey en spices dey scent and en lip bi like flower wey dem spray myrrh put.
5:14 En hand round like gold with beryl stone and en body bi like elefant horn wey dey shine like safaya stone.
5:15 En leg bi like pila wey dem design with marbol and gold; while en face bi like cedar for Lebanon.
5:16 En mout sweet well-well to kiss and evritin about am, dey sweet mi for body. So, Jerusalem wimen! Dis na wetin my love bi like.