Library · pcm

Song of Songs 8

8:1 I wish sey yu bi my broda, wey suck my mama breast. Den I for fit kiss yu, even if pesin dey look us and nobody go tok anytin. 8:2 My mama wey tish mi, I go take yu go en house. I go give yu betta wine drink. Yes! Even my sweet pomegranate wine. 8:3 Yu go rub my head with yor left hand kon massage my body with yor rite hand. 8:4 Jerusalem wimen, make una promise mi sey una nor go disturb awa love. 8:5 Who bi dis wey hold en love dey waka kom from di desert? I wake yu up from under di apple tree where yor mama for born yu. For der, yor mama dey kry with pain, wen e dey born yu. 8:6 Make only mi dey yor heart and make I bi like betta ring for yor hand, bikos love strong like deat and feelins for pesin, bi like grave wey nor dey full. E bi like heavy fire and e dey katch well-well. 8:7 Even strong wota nor fit kwensh love; river nor go fit swallow love. Pesin nor go fit buy love with all en propaty, bikos dem nor dey sell am. 8:8 Wi get one small sista wey neva get breast and naw, wetin wi go do, wen one yong man one marry am? 8:9 If e bi wall, wi go build towa with silva for am; but if e bi door, wi go protet am with cedar. 8:10 I bi wall before and my breast stand like towa where dem dey keep tins put, so wen ever my love look mi, e dey always dey happy, bikos of wetin e dey si for my body. 8:11 Aldo Solomon hire en vineyard give farmers for Baal-Hamon and each of dem dey gi-am 1,000 silva koin wen ever dem harvest di fruit. 8:12 But na only mi get my vineyard and Solomon nor nid to pay 1,000 silva koin. But I go give two hundred silva koin to di pipol wey dey kare for di vines. 8:13 My love, make I bi di first to hear yor vois from di gardin, bikos my friends dey wait to hear am too. 8:14 My love, make yu kwik kom meet mi like gazelle or yong deer wey dey on-top di mountin where spices for dey grow.